For clarity Bitcoin na for everybody but trading na for professionals wey understand di risks wey de involved but many newbies no understand how trading de go because dem think say na get rich quick scheme. Bitcoin no be like shitcoins wey fit to pump overnight but it you waste time to collect profit you go lose di capital wey you take invest, if you want to succeed for Bitcoin investment you no need to de in a hurry to take profit. Dat na why DCA strategy de recommended for investors so dem no go carry for mind to take profit on di short term. Trading de give quick profit but e de very risky while Bitcoin investment de slow to give profit but e de more reliable because na store of value.
Bitcoin fit actually pump overnight, but no be like shitcoins, at least bitcoin own you dey sure no be some few group of developers dey pump am somewhere only to later dump am make investors just dey hold the bag. You dey correct for the things you talk, both about the trading and investment part. The reason why plenty people dey actually rush into trading, na due to the potential of quick profits wey dey involved, them no bother to reason the risks wey dey involved, this na because majority of the Nigerians wey dey enter the crypto sphere, either the trading side or the investment side, just dey find where them fit dey get daily 2k wey them fit take sustain, so that long term mindset no really dey there eye at all.