Nawah oooo
How person wan survive this one now?
Crypto wey they turn to dust already, loses of money here and there and the only thing these people fit do us na to dey pay tax ontop crypto?

I be wan ask my country people, how abi what is ya plans about this crypto tax thing for Nigerians? I no dey see people talk about this online ABIT everyone just dey pretend like say this no be issue at all?
I no surprise with all this stuff because I no say na naija we dey, anything wey go make country better no dey our government eyes, ba to collect tax up and down on top of money wey people dey manage, as a citizen, make anything no be surprised for you because we know how our government dey do when it comes to money matter and they are not doing anything for us to benefit from, as we dey talk like this they don make am compulsory and i think there is nothing anyone can do about it as e come be like say no body fit dey against it, make we just pray say make god no stop to dey give us our daily bread, if not we go suffer for government hand.