You no go blame am sha and I see reason for wetin you dey talk too because if you dey unveil person into something like bitcoin, you go get let them know how the matter be both the positive and negative aspect of am so that if anything happen tommorrow wey be say dem loose their asset due to liquidation or crash anyhow e be dem already know say you don tell dem make e no be like surprise say dem dey see am for the first time and you no tell dem but make e be say dem don hear am from you for you to dey on the safe side because people dey funny sha and dem fit do you something wey you no go believe because say you kust make mistake of not telling them the negative aspect of am to prepare their mind ahead of time if anything funny happens.
Nah the Koko be this. For where money dey concerned, you need to talk the whole thing plainly so that wherever them wan carry you go, your word go still remain the same. No be everybody like Bitcoin, but because of say e fit give money, them go wan buy the idea but if them no get wetin them dey find them go start to twist mouth.
People funny sha, dem go wan to make profit from something but dem no like that thing and the process wey dey involved and if you make the mistake of not telling dem how the process dey go and anything happen, dem go use you shine be dat so as a fast guy wetin you gat do be say you go let dem knoe every every wey dey the sytem both the good the bad and the ugly make den dey aware so that e no go dey dem like film when e happen and by so doing, you don clear your name from that matter of dem reacting towards you.