Naija politics matter self don tire me, dis man wey Dey power now ready to do anything just to win the second term, we all know how desperate d man Dey for power, him ready to take out anything wey fit block am from winning the second term. Dis alliance I no dey sure say e really make sense, because I no sure say dis two people go for unseat tinubu. With the look of things now maybe na Kwankwaso go wan be president, and Obi go be VP and if dem arrange am like that, Obi go lose plenty supporters, because everybody know say for dis country VP no Dey do any work, dem no get any say na president be d main thing.
I just hope dem go fit unseat dis man wey Dey power now, d matter don tire me, e just be like say we no get
President for d country. See how dem Dey kill people for different parts of d country, and dis man just luck up like say nothing Dey happen.
You don already pinpoint wetin go bring problem from this obi-Kwankwaso alliance. Peter obi no go accept to be VP and Northern fit no go like vote an igbo man as president. Make we dey see sha,we never can tell now if the alliance will work because we have witness lots of betrayal between politicians in the past. Make we just hope say Kwankwaso no go betray Peter obi because nothing our nigeria politicians no fit do for money. Based on the results of the last general election,Peter obi would've won if say Wike and his G5 governors been back am with votes from their States. the way APC is oppressing other parties, the chances that Peter obi will win the upcoming general election is slimmer.