Overall bitcoin is far beyond Satoshi alone now
Logically maybe, but technically it's not - creation is never bigger than the creator; one wrong move from Satoshi if he's still alive and the whole project would go to zero. The whole ecosystem is built on trust and once that or broken it's gone..
This your creation way no big pass the creator, I no believe so o. Just as e dey expected of students to better their master, na so e be for all these kind things o. Yes, e get those unique qualities or means of doing something way go put your teacher ahead but, e Dey easy for you to understand new concepts than your teacher.
Same Dey apply for creation, the limit way you don set something go be and the path way you expect am to take, fit no be where e take last last. Na there Bitcoin carry Dey pass Satoshi o, e don Dey do pass the white paper.
I nor sure sey people go dump just like dat once dem see Satoshi. But people go dump and dump heavily once dat address wey we know as Satoshi address move, even if na a fraction of dat 1 million BTC move. Na d only thing wey me think fit make Bitcoin dump in respect to Satoshi's appearance.
It all depends on who they see

make you see say na Tinubu be Satoshi or an African man if all the Oyibo no go dumb the project to zero.
Abeg o, no make me laugh this night like this abeg. Our own agbado and bulagba go come up say na him be Satoshi,,, watin en go wan talk cef to prove himself or go even be en reason why e no monetize am since for en won selfish interest. Omo, nothing good Dey come out of that kind person for sure. Even if them say e no get plenty life inside am again.