I no really understand why people go join money do investment especially if them fit get access to exchange such as Bybit and any other crypto exchange. I cum across people dey argue on percentage them suppose share for their investment but one person say na him bring the idea and na him also get exchange account say na him suppose collect higher amount pass person wey bring some part of the money to the investment.
E no really make sense, and this sounds fictional sef cos why….weyin be bring idea about bitcoin investment? Dem dey take credit for that kind thing, if this is real they the second guy wey dem share the idea give am nah Mumu because he didn’t do any research before investing him just give that guy him money.
Wait sef…Wetin bring percentage for inside their investment? Shey everybody know how much him put? Nah simple math naw! Except if the person whose the investment is under his custody is trying to be greedy.
I wan know if you people bring money equally to make investments na who suppose collect higher or them suppose share am equally?
You can purchase or invest with no matter how small the amount you have is, so it’s completely abnormal to say people join money do investment especially if it not a physical investment like real estate that might require huge capital.