Na where them get am wrong be that sey Bitcoin nor dey for quick profit but nar for long term profit, dem only dey hear sey people don make am through bitcoin investment and dem come dey rush to invest with the high hopes of quick money but the thing wey dem fail to ask the people wey dey tell dem or ask themselves na how long those people wey don make am take invest before dem dey successful.
Wetin I see for this mata na poverty mentality dey cause am because if person nor get money, him nor go ask how but all him go dey reason na make himself follow vet d money without asking important questions to no as he dey be.
Bitcoin investment nor be rush at all but na slow and steady profit as time dey go the more profit you dey make .
Na the mentality wey our people get be this, If dem see person make money through something maybe like Bitcoin, instead of dem to ask so dem go get guide about am, dem no go ask, instead dem go wan rush to do the thing with the mindset to make am quick. And dem go dey expect to be successful like others wey don tey for the thing, If the thing no later favor dem, dem go start complain say maybe the thing no legit, or dem go dey call am bad bad names.
Bitcoin no be one day journey, people wey we dey see successful with Bitcoin today don take plenty years dey patient to dey watch dere investment grow and na wetin make dem successful today. Na like this e for everybody, dem no dey perform any miracle to invest in Bitcoin you gats to hold am for long term before you go become successful through am.