Nor be even, "might be...", dem be already. Organization wey dey take midnight storm persin house without warrant simply bc dem suspect sey persin be Yahoo boy na thief dem be. Dat's why I nor get pity for those wans wey dat doctor light wen dem storm him house dat night. Anyhow people. Instead of dem to be upright, na still dem dey do anyhow. Na why wen VDM challenged dem dat time, dem nor fit do nothing.
But true true that storming for person house way them they do they very illegal ooh because normally even if say government get power to do anything but no be all actions them go fit do without some paper work, if you see were EFCC they scatter person door to go inside you go think say that person way them they find they wanted by the federal government because of how them they take find am, person way they like VDM suppose plenty for the country because him no they gree for anything and na only person way be say EFCC they comot cap for am.