So watin you think say be the main reason why people way get sense about cryptocurrency or done dey for crypto business for long, dey fall victim of scam, na greed dey cause am, FOMO, overconfidence, social pressure, watin dey really cause am?
English no dey permitted. no write with English for here.
E get watin me I understand for this life be say, person no fit dey care finish. No matter how you get sense reach, no matter how you wan use dey careful reach, one day you must loss guard and hence that one happened, guy men don chop be that.
So wetin dey ground be say, careless self fit make an experience person fall victim of scam like person wey dey learn. When we take action with without checkmate things in the way wey we surpose do. Again, sometimes greed fit cause am because that one na our own nature as African man, no wey we fit commot that one for body. Another thing I wan talk again na try luck. As in, some people go know say e fit no dey legit oh but based on say dem just one try luck if e fit enter for them, at the end of the day dem end up to be victim.