Big institutions no dey play: Spot ETFs and big companies still dey accumulate quietly whenever retail traders dey fear. (
https://bitcointreasuries.net/)
You don forget say wetin make the crypto red na say institutions dey sell heavily, and na the same institutions you dey put hope on say them go deliver you to regain price. So make institutions no sell, make them just dey buy? E get topic I come across wey dey vex for institutions say e dey hurt crypto.
Wetin me I know be say, whether institutions bulk purchase or not, crypto go reach en milestone, I no care about institutions like that, what I care about is demand and supply affecting the price positively and negatively.