Bitcoin Forum

Local => Nigeria (Naija) => Topic started by: Hatchy on December 27, 2023, 02:16:45 PM

Title: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Hatchy on December 27, 2023, 02:16:45 PM
My People, Una weldone o. If una see the joy wey I dey get like dis so, una no go believe as I be like person wey don chop overfeeding. Well as Una see the title, history of nija local board. I just dey reason am say as many new naija board members dey enter forum, Dem suppose still know small history of how our oga Dem take fight their way till we finally got our own local board last year. Yes last year so we are actually just 1 year old. Hurray nija board members although I wasn't here at that time, but I'm grateful to be a member of this wonderful forum. And so far nija board has shown many impressive statistics in d past few months and we are happy to be amongst d most active local boards of d forum. Thanks to many of our new members and oga Dem wey dey do all their best to make sure say the local board dey clean and much more interesting than when it was just a single thread. Well enough of the talking, follow me through this short history of naija board and be amazed, just as I dey when I dey compildis thread. Like dis now, we don show say really, we Nigerians no dey carry last.

In d early days of the forum, when Bitcointalk nova dey popular as e dey now for we country, our old oga Dem find Dem way to dis ogbonge forum. And having being an African, a Nigerian, all of dey do very well here for BitcoinTalk. Dem really represent us d Africans very well, con create better reputations for inside dis forum. So far, some early men Come see say e go make more sense, if Nigeria get Dem own local board.

So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=940323) come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5107528.msg49639304#msg49639304). Dis request was shocking and other men for naji wey see say d idea make sense come support d thread well. Dem hold ground with our oyibo men Dem. If you read through d thread you go see how many people Dem use mouth take finish our people Dem but Dem no gree. Sha Dem no grant d request dat time,but other many top oga con suggest say since na d first request, e go better make we first create something like a local language thread first. Dis idea na to calculate d amount of active members wey dey we country before Dem go fit reason to give us we Localboard.

With so many suggestions, on d 17 of march, 2019 oga CryptopreneurBrainboss come create de African bitcointalk community hangout (https://loyce.club/archive/oldposts/502/502053xx.html#msg50205374) thread. Dis name wey he give am, na to give way for other countries Dem wey dey Africa to tay take part for d discussion thread.

Images of old African community thread:
https://www.talkimg.com/images/2023/12/26/IJAXP.jpeg

To bring awareness about d Africa Bitcointalk community hangout thread, @CryptopreneurBrainboss come reason am say e go make sense to start a signature campaign. Dis campaign na to take show other African people Dem wey no dey aware of d thread to no about am and join d discussion. Dis was how d Africa Bitcointalk community hangout signature campaign (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121541.msg50198448#msg50198448) was created.D campaign dey for both paid and free volunteer signature dem. other members of d forum like and appreciate d idea wey brainboss boss bring and some con help create signatures and avatar even personnal text for dis campaign to take start.

Some of the early avatar : created by cabalism13 (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=1605387)
https://www.talkimg.com/images/2023/12/25/IvsIN.png

https://www.talkimg.com/images/2023/12/25/IvIA9.png

D signatures for d campaign: created by @ Heisenberg_Hunter (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=1564795)

Quote
Member rank
▬▬▬▬▬      BITCOINS - AFRICA      ▬▬▬▬▬  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.0)
There's a thread dedicated for Africans to hangout and discuss general issue and issue relating to blockchain development in Africa.
▬▬ Join Africa Bitcointalk signature campaign ▬▬  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121541.0)

Full member

Senior members and above

░░░░░░░▄▄▄▄▄▄
░░░░▄██████████▄
░░░██████████████
░░██████░▐▌░██████
░█████░░░░░░░▀█████
██████▄▄░░▄▄░░██████
████████░░▀▀░▄██████
████████░░▄▄▄░░█████
██████▀▀░░▀▀▀░░█████
░█████░░░░░░░░█████
░░██████░▐▌░██████
░░░██████████████
░░░░▀██████████▀
░░░░░░░▀▀▀▀▀▀
░░░▀▀▀████████▀▀▀
(https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121289.0)
B I T C O I N S
A  F  R  I  C  A
(https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121289.0)
|
Are you willing to educate Africans on blockchain and cryptocurrency? (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121289.0)
Join Africa Bitcointalk Signature Campaign (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121541.0)
|
African bitcointalk
community hangout
(https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121289.0)
Personal text: suggested by @joeperry (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=97179)

Personal Text: Africans on forum, click my profile website
Website link: https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.0

After  sometime, d thread come dey go well, and @ CryptopreneurBrainboss come think am say e go better make we fight first for we own board den we fit later join fight for other african country board dem. E also noticed say everybody wey dey talk for inside d thread, na mostly nija people, so e come decide say e go change d name of d thread to Nigerian Bitcointalk Community Hangout. (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.0) and dem come accept just two languages for dis thread wey be ENGLISH AND PIDGIN

Read am for here, why e change d name:
So see wetin happen wey make thread don change. We Nigerians we sabi carry Africa for head but others no dey reasons us like dat. E come be like we dey waste our time for here as na only we we dey here. Some people come reason me say make we fight for our own first then we fit fight fight for odas and I come see sense for wetin dey talk na e make I sharp sharp change the thread to focus more us, Nigerians.
As e be now eh, the agenda never change as na to get our own local board be the priority, if we fit achieve am everywhere go strew for us. We just need to dey very active atleast once a week for the thread and contribute towards the matter wey we dey address.

Times pass and d local thread don show better statistics and more active members Don turn up in the past few months
Some of d active users wey dey d old thread in 2021 quote from lordhermes. [members upward]
Edited by me
Code:
Active users
_____
1. CryptopreneurBrainboss
2. Becky666 [color=red]Rip[/color]
3. Mpamaegbu
4. Yourhomeboy
5. Sharon121212
6. Upgrade00
7. Leonardo7
8. nelson4lov
9. Soldierswitlittlefaith
10. Gozie51
11. posi
12. Charles-Tim
13. Josefjix
14. Alobo Realer
15. Maestro75
16. BIT-BENDER
17. Oshosondy
18. gabbie2010
19. Lordhermes
20. GeorgeJohn
21. Smartvirus
22. Traderbtcc
23. abdulodoi
24. awawo
25. Fivestar4everMVP
26. Miaallen
27. Blackpussy
28. BIN-BIN
29. ololajulo
30. CryptocurencyKing
31. Crptomagma
32. Onuohakk
33. Pokapoka124
34. thereader
35. igehhh
36. Lmaooo
37. Coyster

So with dis turn up from our naija people Dem, our oga @ Charles Tim con create d 2nd request for we local board  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5315340.msg56289652#msg56289652)on d February 07, 2021. Dis request again see many supporters because even Dem oyibo Dem notice say d naija thread show many positive movement and many new posts don dey created for d local thread in d past few months.

for e request, e also talk say make admin still give us some childboard and dis was d first request for we nigeria childboard

Child-boards
  • Altcoins
  • Marketplace
  • Off-topic

D request was still not granted, dis wan na becos Dem say d local boardthread speack more of English pass pidgin and also d activity from d local thread still no reach to tay open Dem own local board. Some oga Dem con advice say make we people Dem try keep d board more active and if d statistics show more activities maybe den admin go reason d request.

I think the reason why the request was denied in the past is because all of the Nigerians On Bitcointalk speak English and admins probably didn't think a Pidgin English board would have many users. But if the number of Nigerians is much higher now, it makes sense that you guys have your own local. However, if your local would allow users to write in English as well, the admins might turn down the idea. A Pidgin English only local would have better chances.

Discuss among yourselves how you would like your board to look and what sub-boards it should have. That helped the Croatian community get new sub-boards a few months ago. Those ides were then presented to theymos and Cyrus and the new boards were created.  

I think it could help to see how many Nigerians there actually are and how many of you are active on Bitcointalk.If the numbers aren't as high as they should be, maybe an African local could be an alternative option. In that case, you have to agree on which local languages would be accepted.

Good luck with the request!

@ Charles tim, on  22, September 2021,con think say e go still good, if admin pin d local thread for top of d local language board just as many other board do Dem own. Dis idea, we e say na other member give am con dey very good. dat one na because e don notice say other thread Dem wey no dey active reach we naija thread just dey block road for we thread to dey top and if our own no dey top, some members no go fit see am. e con create e Request for pinned Nigerian local thread (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5361344.msg57999668#msg57999668) make admin for pin d local thread.

Quote
Recently, one of the veteran members hinted me to first seek for our local thread to be pinned, that it should be what we should first seek for, that later we can seek for a local board. I have sent pm to Cyrus before, and I believed one or two members might have sent pm to Cyrus about our local thread to be pinned (just a guess). That is why we think sending pm directly may be inappropriate because the thread has not been pinned ever since then, that is why we want to make it official and public on meta board, we highly hope the Nigeria local thread will also be pinned.
Nigeria local thread is one of the most active thread in the other languages board but yet not pinned, there are 22 threads pinned while 21 are local threads, some of the local threads are not even active but taking up space while making Nigeria local board not visible as it should be, that is the reason we are now requesting for the thread to be pinned.

Shockingly, dis request no take time at all. Admin approved d request, con pinned d local thread put for d other local languageboard on 23rd September 2021. dis one con be happy moment for everybody for we local board as na e be d first request wey Dem approve for us.

A message from Cyrus to CryptopreneurBrainboss
Good day Admin, I would like to request for the Nigeria local board (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.0) to pinned for more visibility. If there's anything I'll have to do or the community will have to do to achieve this please let me know, thank you.
Regards,
Brainboss.
Hello,
Done! Sorry for not doing it by now. I'd suggest renaming the thread to match the standard of the rest of stickied threads.
Best,
Cyrus.

Na so d year 2021 Tay end and admin Dem no still give us we Nigeria board.So far, our oga Dem just come focus on trying to increase our local board activities and speck more pidgin as a suggested by other members.

After a while, d request (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5315340.msg56289652#msg56289652) thread by Charles tim don almost dey forgotten, den @ Mpamaegbu (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5315340.msg59840396#msg59840396) con decide to bump d thread again in April  2022 Dis bump wey e do, na to tay remind our admin Dem say, we still dey in need of d local board and hope say Dem go still approve am.

So far over d month, naija thread con show better improvement and when @ Rikafip con do he monthly statistics, e con see say naija don climb go up as d 11th most active local thread for d last few months.dis wan na better improvement

E don reach 9 month, since d last discussion about d nija board don happen and no reply from d admins. So far everybody don relax come dey do Dem best to keep d local thread active. Then one faithful morning;

Na for d early hours of d day, December 21, 2022, 06:05:53 Am,  our oga @ CryptopreneurBrainboss come bring great new for d local board. Finally d long awaited local board was approved and created by admin theymos. Dis news was a wonderful celebration for d Nigeria community.  At last, admin con see say we too need our own board and use am Tay do Christmas for us. D whole local board happy and con dey thank theymos for dis wonderful thing wey e don go for we Nigerian people Dem.

NEW TOPIC: Congratulations everyone, we made it, welcome to the Nigerian (Naija) Local baord.
I wan used this opportunity say thank you to everyone of you that contributed to the success we'll be celebrating today, the creation of the Nigerian local baord. Like play like play, I gat message wey come from theymos few days back asking for recommendations on how the Naija board go be like, After some deliberation with some members (Igehh, Charle-Tim & Mpamaegbu) and few questions answered to theymos, we decide to allow theymos freestyle the whole thing. And today we have the Nigerian local board. No subbaords were created but just the official language which is Pidgin and English.

Although d sub boards as requested no dey but, it was at least a gift worth acknowledging.
After sometime, our oga brain boss, come first lock d local thread say talk to say make people dem for fit go dey post for d main local board till further notice.
Click here to read why  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg61478216#msg61478216)
The naija Local thread, was later edited by our oga @ brainboss to Naija Novice Hangout {Newbies introduction & Orientation} Thread. (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg50205374#msg50205374) dis one wey e do, na for our newbies dem to take introduce dem self and avoid spamming d local main board with many introduction topics.

https://www.talkimg.com/images/2023/12/27/IL8bg.jpeg

Well, dis na d history of how our local board Tay come into existence, thanks to great legends like Igehh, Charle-Tim, Mpamaegbu, CryptopreneurBrainboss for Dem great efforts so far. Abeg make una dey try give these men all respect even though Dem fit no senior u for age, but if no be Dem, we for no dey here today. I greet una bosses Dem and thank una for una good work and effort so far.

Some other requests by our naija local board;
Proposal For Naija (Nigeria LB) Sub-Boards Creation (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5473185.msg63118313#msg63118313) by Agbe

Request for merit source;

Charles-Tim merit source application + Nigerian local board (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5360200.0)
Igebotz Nigerian Local Board Merit Source Application (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5462533.0)
Upgrade00 - Merit Source Application (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5378658.0)

List of important dates to note on nija board

  • first naija board request by Mpamaegbu on February 08, 2019 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5107528.msg49639304#msg49639304)
  • African bitcointalk community hangout thread created by CryptopreneurBrainboss on March 17, 2019 (https://loyce.club/archive/oldposts/502/502053xx.html#msg50205374)
  • Africa Bitcointalk community hangout signature campaign by CryptopreneurBrainboss on March 17, 2019 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121541.0/)
  • second naija board request by Charles Tim on  February 07, 2021 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5315340.msg56289652#msg56289652).
  • death of our own member becky666 : (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=2526732) 06/05/2021(not sure, but @brainboss received message 2 days after his death on 08/05/2021[url=http:// (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg56980147#msg56980147)
  • Nigeria Bitcointalk Community Hangout, First Purposeful  [2021] donation for deceased member becky666(rip) date :May 12, 2021]
     (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg56994255#msg56994255)
  • Nigeria Bitcointalk Community Hangout, First Purposeful  [2021] donation for deceased member becky666(rip) date :May 12, 2021 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg56994255#msg56994255)
  • first naija board translated post, don by  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg57081977#msg57081977). Igebotz (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=1045971)
  • cyrus pinned the local thread to the other language boardon September 22, 2021 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg58002404#msg58002404)
  • Request for pinned local board thread (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5361344.msg57999668#msg57999668)
  • NAIJA 2021 LIBRARY (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg58878212#msg58878212) compilation of naija board 2021 topics  (http://)
  • First nija Yoruba thread (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg58903806#msg58903806) by kimkibu (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=917349) although our people dem no accept d thread becos na only pidgin and English na de! Accept for we local language.
  • [CHARTS] first Monthly Overview Of Nigeria Local Board📈 Monthly Merit Reward by Igebotz on August 31, 2021 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5357434.msg57824603#msg57824603)
  • creation of the Nigerian (Naija) Local board on December 21st, 2022 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5121680.msg61474220#msg61474220)
  • First NAIJA BOARD ART CONTEST December 24, 2023 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5479089.msg63377759#msg63377759)
  • Addition of our own Localboard moderator @ Igebotz on May 1, 2024 (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5493990.msg64018740#msg64018740)
  • creation of our Politics and society, off topic subboards (Naija) on May 02, 2024 (https://bitcointalk.org/index.php?board=279.0)

Donation threads done by some of our early people dem
A Crypto Christmas; Using Bitcoin to help feed the homeless by satoprincess (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5378524.msg58812798#msg58812798)

Project Covid-19: Supply to 50 (Now 70) families in Nigeria, Images {Donate👇}by CryptopreneurBrainboss (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5252309.msg54534451#msg54534451)

Projec Covid-19 : Supply to 20 families in Nigeria (Completed successfully) by CryptopreneurBrainboss  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5248842.0)

I Have Donated My Campaign BTC to buy Laptop for Practical Classes by Agbe  (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5405990.msg60555094#msg60555094)

Quote
abeg, if my our oga Dem see or know of any thing we no dey here, abeg make Dem notify me for dis thread. And if I give false information abeg make una still talk for here. Thanks for reading

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Mpamaegbu on December 27, 2023, 04:16:39 PM
So on d 08 February, 2019, our oga @ Mpamaegbu (https://bitcointalk.org/index.php?action=profile;u=940323) come create d first ever nija board request thread wey e title Nigeria Local Board: Theymos take Note (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5107528.msg49639304#msg49639304).
Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

Na true, dat time nor be small gbege we face because naija been get serious bad image everywhere and d senior men before us nor too get d strength of disproving d bad image wey owa leaders dem put us into. Anyway, we thank God for where we don reach today for the LB matter.

Nice wan, OP. I for pour you beta colele wata but sadly na only wan bottle dey my fridge now.

Shout out to all men in da house! Happy New Year to all of una.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Amphenomenon on December 27, 2023, 10:02:23 PM

Mpamaegbu and CryptopreneurBrainboss God bless both of you and everyone who supported you guys especially those who supported in the Africa Bitcointalk community hangout signature campaign, Omo even our great grandfather Jet Cash supported us. Thanks to Charles Tim and Igebotz who later joined the fight God bless you all and every of our local members. May Becky666 continue to rest in peace.

Seeing all these donations by CryptopreneurBrainboss, Satoprincess and Agbe would have suggested we continue that Christmas donations especially now when economy are this bad.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Mia Chloe on December 28, 2023, 01:30:39 AM
Wow!!! I am so pleased and surprised to have seen this thread. Although my little time on our Naija local board I didn't know so much about our board. However with the help of this thread I have been able to understand and know many new things about how Naija board really started.

I wan sti use dis medium take thank our bosses Dem 4 d effort way dem put to make sure say Naija board get head. I wan sti Thank Hatchy way e tay put dis thread together. Abeg ee shout out to Naija board we 2 much .Naija no de carry last true true.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: nelson4lov on December 28, 2023, 10:31:45 AM
I got the notification about the mention in this thread. It's nostalgic and I like it. Kudos to you @Hatchy for a trip down to memory lane. The journey to getting this local board is a continuous one. Although only a few members started to journey, we now have a community backing the movement which is a big plus. A big thank you to members wey been go above and beyond to request and fight for the interest of the community. At this rate, we go soon get separate as per the request made in local board.

To all new members joining the community, you're welcome  :)

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Samlucky O on December 30, 2023, 03:44:35 AM
Respect to our Heros who don make out there Time to make sure say this we naija local board stand today e no easy. Piking wey dem carry for back no no say journey far. And also Piking wey dem born to a wealthy family no no how much be bag of cement, or no even know how e Papa carry build Empire wey him dey enjoy.

Shout out to all of our naija Ninjas wey don fight for wetting we dey enjoy today. All My oga them @crytopreneurbrainboss @hugeblack @charls-Tim @Agbe @Mpamaegbu @Igebotz @Upgrade00 and to you @ satoprincess your donation or charity to people also bring attractions of Goodluck to us. may God bless you also to @brainboss for the covid19 disbursement of food, also to @Agbe for the introduction of bitcoin to students with laptop for study. Ona really try. if this forum they put calendar of the past Heros like Nigeria past Heros, we for don paste am here sothat any newbie wey dey come here sopos no the people wey dey dey follow chat say no be just any how people.

I respect ona, and the memory of wetting ona don do go always dey in our heart's. If not for ona how we fit dey enjoy benefits wey we dey get here? Now people dey push enter the forum almost every day dey creat thread up and down not knowing say the privilege na people bring the idea. once again I thank you all for your efforts. Thanks to you @Hatchy, for compiling this for people to know the origin of everything, because e dey give honour to those wey participate in making something a success. Thanks to @mia Chloe for bringing up the latest art contest too, because na those things go dey make here lovely and lively and with our talent we dey showcase for here go make the international people for the forum to change there perspective about us. and them go see a better part of us no be the negative side. I see say those men dey visit 9ja local board more often than other board that is to say them dey highly impressed with wetting we dey do. And our negative tag don dey comot. Ona Weldon.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Su-asa on December 30, 2023, 06:03:08 PM
This na good start my guy, as e be say me na new person for this forum, I just come as Jonny just come, so I ne really get the full detail about this forum qnd the history of this forum bur thnaks to you as yiu come tell me/us small way you Sabi.
You try to update us th
is mata because no he everybody way dey here na Sabi part of the history for this place.
A very big shout-out to the heros on our local board for the good works they did to make sure that this our board is in existence today, it wasn't an easy mission to accomplish.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Richbased on December 30, 2023, 10:07:53 PM
I commend all those our senior men them wey stand strong for us to achieve this our local board Una try well well o because I just dey wonder how the newbies them for do had it been say we no come get our own local board as in be say Dem never get any much experience like that but as we come get this local board, e come be like say e relief almost every body wey from Nigeria wey dey this forum because we dey interact with each other well and imagine some threads wey some of our members here carry come local board to advice us and also to correct some of us wey dey go wrong direction like for example the thread wey @adbitco create Abeg make we mind wetin we go talk for english board to avoid problems (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5477854.0) and also the one wey our senior man wey be @Agbe create U don Plagiarist ursef (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5478599.0) and Follow Instructions to Avoid Deleting of Application. (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5479293.0) and so many others so if we no get local board how we for take dey give ourselves advice Dem like dis and our local board really help to unite some of us outside this forum so to all of una wey make this our local board be like this we dey celebrate all of una and I also commend una doggedness to dey protect una brothers for reputation board, people like @legendary Charles-tim and Nwada001 and some other people wey I never recognize, I dey see una hand for reputation board na una be our lawyers wey we get for our local board make una still continue d good work o, together all of us go change the bad name wey some of our youths wey go involve themselves for things wey no good come give every body bad name but wit time you and I will change that narrative. Una well-done o

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Nwada001 on December 30, 2023, 11:59:21 PM
~snip~

Thank u say u try recognize some of us for here, we they stand when necessary, well make I just talk for my self, if I see were person hand clean for my own view I they try with Watin I understand to put people for that area way dem fit see say the person no really they as bad as dem think say eh dy, but for case way be say the person don use him own hand scatter everything nah just to leave the case mke the person suffer him faith.

Watin I they try talk be say even if onah get who they help defend onah outside, eh no mean say onah no go bring head down nothing good pass were person fit just they avoid trouble any way possible way u fit avoid am no fall law, becuz if u break the forum law even your own lawyer fit they against you cuz eh get as eh go follow the case him own head fit enter and that law license dem fit take am from am, for here we love ourself no matter the attack nah just to put things for the local board in other eh no pass so.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: CryptopreneurBrainboss on December 31, 2023, 08:40:11 AM
Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from. This fight no start as Nigeria fight but as Africa and threads like this (No African local board (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5072073.msg48051728#msg48051728)) na wetin open our eyes to the struggle. Mpamaegbu come bring the appeal for a Nigerian board, dat time I dey full member and many of the OGs here still dey very lower rank. I remember because na when I reach Snr member wey I create that hangout thread and then we had a place to brings heads together and got what we have today.

If anybody here has to take credit na Mpamaegbu as na him open our eyes we come dey come together as one family and today we dun big like this. We still dey grow sha and small small we go get a bigger board wey go dey compete with the other boards but to do that we need more quality posters and as we dey post make we no only dey run am say we want complete weekly quota but to add quality to the board so anytime wey we request for anything them no go waste time approve am for us.

We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Hatchy on June 09, 2024, 03:14:21 PM
I don update our local board history with the new dates wey Dem give us Localboard moderator and the subboard creation date. so far we dey happy well well as our Localboard don dey do well sofar and come look presentable. Una do well, Igebotz and all our members wey dey make quality post for we local board and present us well outside main board.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Igebotz on June 09, 2024, 04:36:02 PM
I had no idea there was so much history; the struggle seemed like yesterday, but it's been almost two years and there have already been some amazing events. I've been hunting for that translation for a long time because I saw someone produced the same translation last year. I believed I did more than one translation that year, but I don't remember anything anymore. I stopped since the nature of the thread at the time made it inconvenient for other people.

OP you ommited our local board rules.... History  ;D thanks.

Chai! I nearly typed disclaimer just now on top this thread sey you mis-tagged me instead of Brainboss for dat topic. I nor even remember startin dat topic again oh, at all. How time flies. You know dat thing dey sey about d internet not forgetting, ba? Dat's why e nor good to naked baff outside.

OG wey no dey gree leave alcohol, nobody everytime wey wind blow wey foul nyash dey open oooo. The bastard wey carry you and Pokapoka mata come Meta that year still dey active for the forum? I remember how we shake everywhere.  ;D

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Wiwo on June 09, 2024, 11:26:16 PM
We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.
For sure we don try for ourselves for this localboard activities and pursuit as as you talk am slow and steady win the race and at this point we are going to remain consistent pursuit in building this community and as you said e make sense make we bring up such celebrations when we go do our anniversary, 5 years and 10 years anniversary too make sense at least by then alot of things go done change and we go done get clear compass as for we're we dey and how we go move forward from that point,although we have done extremely well in this short time,  but there is still more to be done that only time can say.

So we go wait and also keep putting everything in order to position our localmore in the limelight, and all thanks to other forum members for the love and support they have shown to the naija community on the bitcointalk forum infact some time I use to think that we are the most loved community around here,considering how we started and were we are presently.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Juicyhome on June 11, 2024, 04:17:25 PM
Although the thread wasn't necessary as we're barely a year old but I appreciate the effort put into creating the thread. Maybe if this thread been dey come out in our 5 years or 10 years anniversary na when I got see more importance to the thread but anyhow sha kudos for reminding us where we started from. This fight no start as Nigeria fight but as Africa and threads like this (No African local board (https://bitcointalk.org/index.php?topic=5072073.msg48051728#msg48051728)) na wetin open our eyes to the struggle. Mpamaegbu come bring the appeal for a Nigerian board, dat time I dey full member and many of the OGs here still dey very lower rank. I remember because na when I reach Snr member wey I create that hangout thread and then we had a place to brings heads together and got what we have today.

If anybody here has to take credit na Mpamaegbu as na him open our eyes we come dey come together as one family and today we dun big like this. We still dey grow sha and small small we go get a bigger board wey go dey compete with the other boards but to do that we need more quality posters and as we dey post make we no only dey run am say we want complete weekly quota but to add quality to the board so anytime wey we request for anything them no go waste time approve am for us.

We dun try for ourselves and we go continue they push forward, all those bigger boards una dey see so, e take dem time to build am to where e dey so make we no dey rush our own. Small small we go get everything. Theymos get how him dey do e things, just requesting won't give us what we want but strategic planning go give us am.
@brainboss you sef Don try, you deserve accolade too, mk God bless una wey fight for the local board to come to limelight. E no easy say out of all Africa countries na Naija first get local board,  e show say una wey be big shoes for the board they represent wella. Naija no go carry last, we go make una too happy for this local board, as you don talk am, we go try make we dey creative post and thread to push the local board forward,  our population go help us achieve everything una want. I say make I join mouth hail una too.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Mpamaegbu on June 11, 2024, 05:46:34 PM
OG wey no dey gree leave alcohol, nobody everytime wey wind blow wey foul nyash dey open oooo. The bastard wey carry you and Pokapoka mata come Meta that year still dey active for the forum? I remember how we shake everywhere.  ;D
Who dey breeet! I remember dat ur shout that year. Mehn! Engineer, nor be small matta dat period but we sha thank God how d whole thing later went. E don tey wey I even run into Pokapoka sef. Abi d dude don join football academy com leave cryptos?

On the alcohol part, na Rivers clique here still be champion. If I lie, ask...read more

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Igebotz on June 11, 2024, 06:39:27 PM

Meh Pokapoka was never the same after the incident, before Dem arrange him matter finish person don already take him slot for the campaign but as the name wey hot that period him come dey run one mixer join so, felt too relaxed. Na so him steeze too come finish. He's not longer active here but you go always see am for campaign applications thread.

The forum life be like Ogboni, if you join, you no mingle with the right cartel even POS operator go get money pass you.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Mpamaegbu on June 11, 2024, 08:29:42 PM
~
The forum life be like Ogboni, if you join, you no mingle with the right cartel even POS operator go get money pass you.
Na true you yarn there!

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Tmoonz on June 12, 2024, 11:37:48 AM
I really thank the op for the wonderful effort wey him put to for the thread and I also want to thank all of our freedom fighters who has made all of this a reality, when I joined the forum and found out that we have our own local board it boost my confidence and am so happy to be a member of this honorable house Nija local baord which has motivated me to write this note.
  
### No Place Like Home

For this life, no place fit be like home. No matter how you waka, your home go always be special.

Lastly, no place like home because of Di love for home dey genuine and strong.

So, no matter the boards you waka go, no forget say no place dey like home. Na there your heart dey  home go always be di best place for you.

Nija Local board na our home

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Marvelockg on June 12, 2024, 12:24:24 PM
This is just so incredible and got me really speechless. Indeed, there is always a story before any glory. Look at us now coming from behind to enjoy the labour and effort our people had to go through just to secure a spot for us on the forum and here we are with not just a local board but one of the most active board we have on the forum.

Weldone, our great heroes!
You've all set the foundation and made the sacrifice that has paved way for us on the forum and we can't applaud you enough.

Now I understand why it bothers most of our senior men on the board when a member of our local board goes to the English board to create an irrelevant thread that speaks bad of our local board reputation.

Thanks boss @hatchy for doing this great work in compiling and structuring this piece in this manner. This should be a must read for all Nija newbies that are joining the forum and it will serve as a great encouragement to all of us to know that we have a voice and people in the global Bitcoin community.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Juicyhome on June 13, 2024, 11:51:08 AM

@Marvelockg you just speak my mind,  the great men that fought for this local board, should be proud of themselves to see their dream been actualized,nothing sweet pass say you dey alive see say ur dream come to reality.

And if them maintain the unity among themselves,  greater things go reach this board, make disagreement cause issues among them, make them know say the hope of all newbies dey on them. I knw sat them no go disappoint.

Title: Re: HISTORY OF NAIJA LOCAL BOARD(how e Tay start)
Post by: Odogwu-Blockchain on June 13, 2024, 11:53:50 AM
Omo, op really take time to arrange this thread, cudos to him, e no easy to post thread like this one, you really dig out how it all started and the information needed to make it easy for the newbies to understand the process how it all emerge to this point today.

My sincere gratitude to Brainboss, Igebotz, mpamaegbu, Lordhermes and the rest that fought from day one until it become reality today, my sincere gratitude to Thelmos too for granting us our request. Well done.