Op the way you sounded you are not a newbie but looks like an alt-account. Well as you said, many people wey dey come here dey think sae na di way dem dey chat for Facebook, Whatsapp, Instagram and telegram di same way dem go chat for here but dem know know sae no be like that. And because of dat many newbies dey create thread anyhow on di local board without knowing the content of di forum. Those links u drop na some of links or threads wey go make u grow up. But there are some motivational threads in the forum which can motivate you to do well and grow faster so you can go and read them. Read these
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5098333.msg49267880#msg49267880 and
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5426574.msg61407689#msg61407689Dis topic really interest me because person fit to dey for dis bitcointalk forum, for a very long time and still im no go rank up, meanwhile you go see some people wey just join after you, sharpaly dem ranking go just skyrocket pass you. So e de very important to learn how di forum de operate. I thank you and di OP for sharing di links, Aldo I don see some of dem before, but e still good to come across dem again, to de refresh di memory. Sometimes sef you fit to de post relevant topics wey de related to bitcoin or cryptocurrencies in general, but still no merit, even sef you go still follow all di forum rules, start new topics, members go de make comments but no ranking up. Sodiafo, I don reason and conclude say, especially for new members like me, na to focus on updating on your knowledge of crypto and trying to follow di rules to make quality posts, eventually top ranking members go notice you and begin to de merit you, and you go rank up.
For me di basic thing for dis forum na to take di advantage of oda people experiences, teachings and informations to expand on your knowledge of bitcoin, in general.