Bitcoin Forum
May 25, 2024, 07:25:23 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: Some dangers in food we eat daily  (Read 184 times)
Makus (OP)
Full Member
***
Online Online

Activity: 336
Merit: 237

Bitcoin!!


View Profile WWW
October 07, 2023, 11:29:18 PM
 #1

This na health matter naim I carry come oo, because Oyibo say "your health is your number 1 wealth" meaning your health even important pass money wey dey ur aza Lol, above all we nor go fit neglect our health for anything because if we nor dey healthy to even carry our laptop or phone write for this forum go tire us,and no way for us to go work wen we take dey get money sef, so today I come to talk about some food dem wey we dey eat for naija wey get nutritional benefit but in one way or the other e dey hammer our system and organs, and if we no take care e fit make us sick and we go spend better money take treat am.
True fact about food na be say, the way your body dey na because of the kind food wey you dey consume and some of these food dem if you no fit stop  am I go recommend make you reduce the way you take dey consume am.


1. Ice fish and frozen chicken:  this one dey very popular for the world at large and some persons dey consume am almost every day either fried, dried or steamed, even some public occasions na this food dem dey serve, the chemical wey dem take dey preserve this product na formalin and this formalin na very poisonous chemical wey severe exposure or only two table spoon fit cause death to human being, and this na still watin dem take dey embalm dead body for mortuary. So just imaging if only two spoon fit kill person that means the some percentage wey we dey take in through these food dey do small small unnoticed damage for our body system wey na long term effect.
Another alternative to take substitute this ice fish and frozen chicken na to buy fresh fish from our local surrounding like market eg na point and kill, river fish etc then for the fowl side na to buy alive fowl oo if e hungry you to chop.

2. Red meat (aka beef): this one go burst your head, red meat wey we fit get from cow, goat, ram, bush meat, etc research say if you eat am too often in large quantity say e go cause heart disease.
And for Nigeria we dey hardly hear of cancer but the most common among us naim be breast cancer]https://www.facingourrisk.org/XRAY/does-eating-meat-affect-breast-cancer-risk#:~:text=Among%20women%20who%20ate%20red,red%20meat%20(lowest%2020%25).]breast cancer and this red meat sef dey cause am. So any female wey u no wey dey eat red meat well well abeg, advise her to reduce the way she dey eat am oo. Those people wey be vegetarian na one of the best decision for life wey dem take be that o because the vitamin for the leaf wey dem dey eat well well go help dem build their immune system, and also leaf na one thing wey dey help the body to create enough blood.
Alternative for red meat na White meat, all poultry birds na white meat and you go fit use am replace red meat

3. Soda(aka soft drink): these soft drinks eg fanta, coke, sprit, Pepsi, etc are all soda and dey are know to containing sugar in large quantity, no mind the one way dem title zero sugar naim worst pass, soda get potential to cause  type 2 diabetes, obesity, fatty liver disease, and an increase risk of heart disease and cancer. No be only soda fit do this damage including fruit juice, all these drinks dem dey contain artificial sugar and that one nor dey good for the body, e fit cause bladder cancer.

4. Akpoo (aka fufu): for this modern day people nor dey get patients to do something well, I day I over hear person been dey say dem don dey use hypo to make cassava  ferment sharparly, so e no ho con reach the exact 3 days again na just few hours, and if you observe well for those of us wey dey buy am well well some of dem nor dey smell like den days, before if you eat akpoo person wet near you go no but now no way because of artificial process involved by large producers.
Then the one wey con pain me pass na the one wey I see korokoro when dem dey use kerosene for fresh akpu wey dem never pound say na for preservation, omor when I see this one my spirit first week I been just dey short of words.

Finally truth of the matter be say food wey dey last well well for our belle when nor dey make us hungry quick when we eat am, na because our liver dey struggle to digest am, to us we fit see am as economical food but to our health we dey over work the liver and this nor good for am eg akpoo, beans, red meat, fatty food etc. Even if e dey difficult to stop dem make we just minimize the wey we dey consume dem.

Sound in case you still no any other food wey dey harmful to our health you fit voice am oo.
Obari
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 616
Merit: 452


I buy all valid country Gift cards swiftly.


View Profile WWW
October 08, 2023, 11:52:42 PM
Merited by hugeblack (2)
 #2

My chairman,  no vex say I come in but I must have to tell you say your post dey very long for me and how you go say make we no chop ice fish and even frozen chicken, abi na the ice wey dey am or werin again na ?
Make all this dieticians get out with their rubbish advice because e be like na almost everything we go stop to dey chop if we dey listen to all of this things and wetin even pain me pass na when I been dey read one ru bish say make we no dey eat garri and I just conclude say this online dieticians dey after my life because me wey no fit survive without garri a day na e una say make I forfeit garri, never I rather forfeit sex than garri bjt no worry I no dey forfeit any of them 😁😄🤣

Little one to add @op, try make you edit your post and make it shorter if you want engagement because nobody go reason your matter or this thread with this length.

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBITCRYPTO
FUTURES
[
1,000x
LEVERAGE
][
.
COMPETITIVE
FEES
][
INSTANT
EXECUTION
]██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
████████████████████████████████████████████████████████
.
TRADE NOW
.
████████████████████████████████████████████████████████
██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
[/center]
Makus (OP)
Full Member
***
Online Online

Activity: 336
Merit: 237

Bitcoin!!


View Profile WWW
October 09, 2023, 06:51:34 AM
 #3

My chairman,  no vex say I come in but I must have to tell you say your post dey very long for me and how you go say make we no chop ice fish and even frozen chicken, abi na the ice wey dey am or werin again na ?
Make all this dieticians get out with their rubbish advice because e be like na almost everything we go stop to dey chop if we dey listen to all of this things and wetin even pain me pass na when I been dey read one ru bish say make we no dey eat garri and I just conclude say this online dieticians dey after my life because me wey no fit survive without garri a day na e una say make I forfeit garri, never I rather forfeit sex than garri bjt no worry I no dey forfeit any of them 😁😄🤣

Little one to add @op, try make you edit your post and make it shorter if you want engagement because nobody go reason your matter or this thread with this length.

Any way thanks for the info but nor go dey possible to shorten the thread because if I shorten am I go throw away useful info dem wey person need learn from. Talking about the ice fish and frozen chicken if you read only that one I think e nor suppose tire you, if you dey complain for the length of this post how you wan take dey read @jayjuangee post dem, or even full thread wey don reach the second page?
CryptopreneurBrainboss
Legendary
*
Offline Offline

Activity: 2268
Merit: 4175


eXch.cx - Automatic crypto Swap Exchange.


View Profile WWW
October 10, 2023, 12:06:12 AM
 #4

Finally truth of the matter be say food wey dey last well well for our belle when nor dey make us hungry quick when we eat am, na because our liver dey struggle to digest am, to us we fit see am as economical food but to our health we dey over work the liver and this nor good for am eg akpoo, beans, red meat, fatty food etc. Even if e dey difficult to stop dem make we just minimize the wey we dey consume dem.

You dun talk wey my brother, and the thing be say many of us sabi all this things but where the money dey to they leave this kind life, the only thing wey we fit do na to reduce the way wey we dey take them as we can't do without them. They're the easiest and most affordable food for the common man and no wonder dem say, rubbish food dey cheap. Red meat wey we dey manage, wey be say with the least 1k you dun buy meat to use chop eat. How dem expect poor man to avoid them. I know e no easy but make we try too dey follow this instructions dem because e good for us. White meat get less cholesterol than red meat and na one of the reasons wey dem say make we avoid red meat (e get very bad cholesterol but many of us no go sabi dat one).

Make all this dieticians get out with their rubbish advice because e be like na almost everything we go stop to dey chop if we dey listen to all of this things

Little one to add @op, try make you edit your post and make it shorter if you want engagement because nobody go reason your matter or this thread with this length.

Aswr like now everything dun bad, I remember when dem been dey advise us to eat red meat but now na white meat be the next agenda. Abeg the cow dun stop to dey chop grass wey their meat no good again but Las Las we need to listen to them because them get point for everything wey dem dey talk but normally you no go listen finish as you go do stop where your money reach. Na dem went us to dey buy online fowl and turkey wey dey cost like wetin I no  know.

PS: This post no long chairman, this is okay for an informative post like this, there's nothing wrong with the OP been big, some post are for informative purpose and if the OP been add more information e no go still bad. Na reply wey supposed dey short and straight to the point although e no bad when you have meaningful things to say to always express yourself. OP you try wella and I go revisit this thread in future.

█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
e
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████████
████████████▄███
██▐███████▄█████▀
█████████▄████▀
███▐████▄███▀
████▐██████▀
█████▀█████
███████████▄
████████████▄
██▄█████▀█████▄
▄█████████▀█████▀
███████████▀██▀
████▀█████████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
c.h.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
▄██████▄▄▄
█████████████▄▄
███████████████
███████████████
███████████████
███████████████
███░░█████████
███▌▐█████████
█████████████
███████████▀
██████████▀
████████▀
▀██▀▀
Obim34
Full Member
***
Online Online

Activity: 252
Merit: 248



View Profile
October 10, 2023, 09:08:36 AM
 #5

Make all this dieticians get out with their rubbish advice because e be like na almost everything we go stop to dey chop if we dey listen to all of this things and wetin even pain me pass na when I been dey read one ru bish say make we no dey eat garri and I just conclude say this online dieticians dey after my life because me wey no fit survive without garri a day na e una say make I forfeit garri, never I rather forfeit sex than garri bjt no worry I no dey forfeit any of them 😁😄🤣
My brother u just dey pour our mind for here, cos i no even understand all the food specialist again, imagine say i stop to eat fufu wey OP mention shey i no go matiate oh cos no other food dey hold pass that swallow

For the matter of smoke fish, na true u talk sha i don do small research on am and we get to reduce the intake


adultcrypto
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 336
Merit: 260



View Profile
October 10, 2023, 10:15:08 AM
 #6

This na one of the things wey dey fear me for food. I know say na wetin we put for mouth dey determine how our body go be so when I hear say some of the things them wey person dey like na danger for body, afraid dey catch me no be small.


Make all this dieticians get out with their rubbish advice because e be like na almost everything we go stop to dey chop if we dey listen to all of this things and wetin even pain me pass na when I been dey read one ru bish say make we no dey eat garri and I just conclude say this online dieticians dey after my life because me wey no fit survive without garri a day na e una say make I forfeit garri, never I rather forfeit sex than garri bjt no worry I no dey forfeit any of them 😁😄🤣
My brother u just dey pour our mind for here, cos i no even understand all the food specialist again, imagine say i stop to eat fufu wey OP mention shey i no go matiate oh cos no other food dey hold pass that swallow

For the matter of smoke fish, na true u talk sha i don do small research on am and we get to reduce the intake


Imagine say smoked fish wey person don dey chop from small pikin reach now , no come good for body. Make I ask, if smoked fish, fried fish, fresh fish, all of them no good, which one we go come chop? Wetin come dey safe like this?

.
Duelbits
DUELBITS
FANTASY
SPORTS
████▄▄█████▄▄
░▄████
███████████▄
▐███
███████████████▄
███
████████████████
███
████████████████▌
███
██████████████████
████████████████▀▀▀
███████████████▌
███████████████▌
████████████████
████████████████
████████████████
████▀▀███████▀▀
.
▬▬
VS
▬▬
████▄▄▄█████▄▄▄
░▄████████████████▄
▐██████████████████▄
████████████████████
████████████████████▌
█████████████████████
███████████████████
███████████████▌
███████████████▌
████████████████
████████████████
████████████████
████▀▀███████▀▀
///  PLAY FOR FREE  ///
WIN FOR REAL
█████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
█████
██████████████████████████████████████████████████████
.
PLAY NOW
.
██████████████████████████████████████████████████████
█████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
█████
Youngkhngdiddy
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 322
Merit: 206



View Profile
October 10, 2023, 04:12:20 PM
 #7

Imagine say smoked fish wey person don dey chop from small pikin reach now , no come good for body. Make I ask, if smoked fish, fried fish, fresh fish, all of them no good, which one we go come chop? Wetin come dey safe like this?

  Na why doctors go talk say make you day chop vegetables and more of fruit, they no say make you no chop oo  but to reduce the intake. Everything way we day chop get their different proportion, cause too much of everything na disease. Fish good for body, make we no forget that one, all this thing way them day try stop us from eating, still day do something for body, for instance that red meat they give better protein, iron, zinc and B vitamins. You see all these nutrients the body need am, but still we gats know the level how we day take am. Na why exercise day very important with am you fit day burn up the fat for body.
  Anything way day enter our body suppose be fresh, but no be so no be every body get that kind privilege. But still more of veggies no bad at all, all this plants get more nutrients pass all this meat we day chop. If you wan try am start one month smoothie challenge then see the out come way go follow. Me !! I day chop anything way I see but as long say I day take am at the exact proportion, and I day exercise too  so I day make sure my system and body day feel the burn. Health is wealth, get better health so that you go fit enjoy you money.
Y3shot
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 602
Merit: 171

Bitcoin👌 or nothing


View Profile
October 10, 2023, 04:40:27 PM
 #8

As for the ice fish and frozen chickens it is not good for consumption of the body because these food are preserved with chemicals that can be deadly to humans life, most of the chemicals used for preservation of ice fish and frozen chickens can result to cancer in the human body. It is better for people to stay away from foods like this because it can be problem to them.  

To stay away from health issues people needs to check the kind of food wey them they eat if e really they good to their health because most of the problem we dey  encounter na because of the kind of food we dey eat.
Timmzzy
Member
**
Offline Offline

Activity: 785
Merit: 34

SOL.BIOKRIPT.COM


View Profile
October 10, 2023, 04:55:20 PM
 #9

With all this things you mention my brotther, the food wey you use your hand prepare ni be the best oh or the one your mama or wife or girlfriend use their hand make ni be the best because like this everything or anything we eat outside no safe lie lie, na by grace we dey survive for this country because, if you see how them dey prepare them just as you talk my brother it is something else.

▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬ B I O K R I P T ▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬▬
▬▬▬▬▬▬▬▬▬  Ultra-Fast Crypto Exchange on Solana Blockchain ▬▬▬▬▬▬▬▬▬
▬▬▬▬▬▬▬▬ BiokriptX Fair Launch is now live in PINKSALE ▬▬▬▬▬▬▬▬
Ever-young
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 1190
Merit: 175


★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!


View Profile WWW
April 20, 2024, 03:41:47 AM
 #10

As for the ice fish and frozen chickens it is not good for consumption of the body because these food are preserved with chemicals that can be deadly to humans life, most of the chemicals used for preservation of ice fish and frozen chickens can result to cancer in the human body. It is better for people to stay away from foods like this because it can be problem to them.  

To stay away from health issues people needs to check the kind of food wey them they eat if e really they good to their health because most of the problem we dey  encounter na because of the kind of food we dey eat.

Na true talk be this and the most important thing be say we supposed to hospital go check how our body dey and also to know the kind food wey we supposed eat and the ones wey we no supposed eat but u see us, we no value hospital like that, as far as our body look healthy we go eat anything wey come out way whether e dey good for our body or not, we no care, wetin we know say we dey chop to stay healthy and that the same food dey still dey kill our body system in a way e dey make us feel sick and it's not good, so we should consider taking our health so important because anything wey we do now, na for future e go affect us and that time, e go start to worry us so mk we try dey mindful of wetin we eat.

sokani
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 546
Merit: 435


View Profile WWW
April 20, 2024, 10:13:08 AM
 #11

Op you do well for bringing dis educative topic here. E get some illness wey we suppose avoid tomorrow if only we go control our feeding habits. I go like chuk mouth small for the mata, I go like add say e good to dey eat suya in moderation. Scientists talk say wen we roast beef in a open fire without oil, e dey undergo reaction and com produce Heterocyclic Amines (HCA) wey dey follow cause cancer for awa bodi. Dem also talk say e dey good to eat suya alongside sliced onions, garbage and tomatoes to help counter the effect of HCA. Anoda food we dey eat wey dey harmful to ur health na agege bread. Di flour enhancer wey dem dey use produce di bread dey contain potassium bromate wey dey also cause cancer.
Makus (OP)
Full Member
***
Online Online

Activity: 336
Merit: 237

Bitcoin!!


View Profile WWW
April 22, 2024, 09:29:46 AM
 #12

Op you do well for bringing dis educative topic here. E get some illness wey we suppose avoid tomorrow if only we go control our feeding habits. I go like chuk mouth small for the mata, I go like add say e good to dey eat suya in moderation. Scientists talk say wen we roast beef in a open fire without oil, e dey undergo reaction and com produce Heterocyclic Amines (HCA) wey dey follow cause cancer for awa bodi. Dem also talk say e dey good to eat suya alongside sliced onions, garbage and tomatoes to help counter the effect of HCA. Anoda food we dey eat wey dey harmful to ur health na agege bread. Di flour enhancer wey dem dey use produce di bread dey contain potassium bromate wey dey also cause cancer.

One thing I observed about some of the can foods wey we dey eat sef enh, e contain some chemical wey oyibo know say e dey poisonous but based on say them use Dem as preservatives, dem go always say e no go cause any harm, and even nafdac sef go come approve am, but the truth na be say many of those things na long term side effect naim e dey cause, the whahala fit no start now, but sooner or later e go come start to dey surface na that time we go come dey call village people as the cause of the sickness, meanwhile na wattin we chop.

One set of people wey I cherish most naim be vegetarians, especially the ones wey know the value and wattin Dem dey do. Red meat normally no too good when you eat am in excessive quantity, especially for adults wey don grow all the necessary growth for live, wey be say na ageing just remain, that red meat go fit give Dem very bad heart disease or even liver problem due to tough digestion. Na why protein dey much recommend for children and less for adults. We fit feel say we dey enjoy ourselves but unknown to us say na kill we dey kill ourselves.
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!