I know say post like this been don dey exist, forgive me, but this one too pain me to express my thoughts for old thread.
Newbie abeg I use God take beg una, make una try dey increase the quality of post. This forum no be where you go just wake up from sleep then anything wey you jam for social media you go carry am come dey talk for board. With the little time wey I don dey this forum and this board to be precise, I know how many of our boss at the top they work effortlessly to try make the local board for dey better and outstanding. But all these una off topic post Dem wey no get head don dey too much. Last year we deliberate on this matter, e come be like say the off topic come reduce but now e don dey come up again.
Make I clear una say, as this our board be first 4 for the entire local boards na so eye Dem dey enter our body, to observe wattin dey happen. And when Dem see say na rubbish post plenty pass the main Bitcoin post, e go come be like say we no serious and we don they compromise. Off topic post get level, e get how you go create off topic but e go dey helpful for us as members of the forum or for our normal lives outside the forum. And e get some kind off topic wey go come even bring Bitcoin discussion for the thread later on, all those na creativity you go take do am. I no go lie you be like we go go back to the time wey Dem been dey report off topic post wey Dem go move to achieve oo. At least that go help our reputation.
Another one again na when we go see people dey go talk rubbish for out side board, guy afa make una use una head pan. Which one go dey go talk like say na Nigeria own naim bad pass for this life, if you wan blab the country come talk for where men go understand come relate with you, no be to dey go sell your own self for outside local board just because you wan try impress outsiders. Omor una wey dey do this thing dey fuck up big time. Una better repent oo, e no good. Why u no use pidgin talk am for local board instead of to dey betray us, they back stab us.
Op is like me and you they reason one thing before you talk this matter enter board, I know say all work without play make John or jack dull for I can say is not in most cases even if it let us balance the table. With some off topic I don't think we are achieving the learning why the board exist, what we need is helpful facts information that brings growth, motivational work and past experience others, the trend ,nature of the market and current news . Where this purpose is not know the abuse is inevitable. Please as newbie is not mandatory you must create topic you can still write useful idea and information on existing topic and get your rewards or merrit, some topics has not comment because nothing to write home or any knowledge to be derived, let's try and help ourself so that the growth will be more efficient because you can be in the board some sometime without gaining better knowledge of off topics become the other if the day.