But the truth be say most people no dey do any of these things wey dem talk.
For crypto world, things sabi move fast, like really fast. The people dem wey be say na them dey win no be say na dem be the smartest, na them be the ones wey dey take actions when others still dey think dey plan plan.
Na dis wan make intent dey different from action. We nor go just desire something without working it out. We admire to do something, we do am. Na for dis reason some of us dey talk sey information nor dey enough to change anything for anybody if dat persin wey receive d information nor activate am by putting am to practice.
Whether na to start Bitcoin node, to launch small DeFi project or to just learn on-chain skills, the important thing na execution. Plans na nothing when you no make waka or try execute am. Even bible talk am say "faith wey no get work na dead faith".
I dey talk am on a steady sey anybodi wey dey here and nor get anything doing outside here in respect to Web3 or proper trading just dey short change dem selves. Honestly, nothing wey dey give convenience at earning daily bread reach online stuff.
So I come dey wonder, Wetin be that thing wey dey really scare us away from executing our plans for the crypto world especially Bitcoin? Those things them wey dey hold us back
For me, na just two simple answers – laziness and procrastination. E nor pass like dat. Anybody wey tell u sey na because of dem busy schedule or capital, ask dem whether dem dey busy pass Zenco.