~
To protect our wallet passphrase no really hard the way other people the make am be when e be say nah about how we no want third party to know about am as we want dey careful to prevent the stealing of am. Nobody go tell me say them no get safe places for their houses where them go fit keep something way dey valuable to them securely. Distributing the seedphrases to at least 3 different locations nah just the secured way against any fire or water from flood emergency because e no fit happen for the various locations at once. The metal object no fit dey destroyed by fire since the letters dem punch am on the metal,
E get the kind fire wey Dey burn metal beyond recognition except you never go scene of fire outbreak and we don see incidence wey fire burn down cars wey Dey traffic some years back and some cars no be like wetin resemble car and even those writings wey Dey inscribed, fire Dey erase everything make your mind Dey 🤣
Stop paying... No matter the fire e not fit erase punched written words on a metal, even nah fire wey be from gas, petrol or any combustible materials e no go still erase am. Nah except say e no dey punched written but just written with some painting, because for car the inscribed letters na painted ones not punched into the car metal body. Know the difference man.