Yes i totally agree with you. It is better for us to mingle together by sharing knowledge based information and also engage in fruitful ventures.
Just like our politicians, no matter how divided they are in different political parties but when it comes to stealing our common wealth they are always united against us. Therefore i also agree that we should not isolate ourselves here at least for the purpose of building one another.
Who be this one na?😂 Omor you just make me laugh until tears come out from my eyes. Shoo na every truth una dey talk?
anyway that na true matter we gats work together. No be the one wey one of our brother go dey report some of us(em fellow Nigerians) dey give DT member just because of merit wey e wan get, that na very wicked act. And wattin pain me na be say, all of us wey e report we no do anything bad against the rules. Even the DT member sef come see the matter come support us. out of everybody wey make that same thing wey em be think say na error na only Nigerians em fit fish out. Anyway I don forgive am, but make we no dey do all those kind of things to our fellow brothers and sister hear for this forum, as we be like this, just take am say we be one blood, make love just dey flow.
To Mr obari, you never miss any eventful something for this local board, things still dey work the way e dey before and more newbies don enter the forum. The only thing na be say, we still dey beg newbies make them try change their off topic posting pattern l, if them never get better quality thing to post them make them just dey make comments rather than to shippost for the local board.