Cyber_warrior
Full Member
 
Offline
Activity: 210
Merit: 131
Contact @yahoo62278 on telegram for marketing
|
 |
December 07, 2025, 10:48:35 PM |
|
Whenever I need any information about bitcoin, or crypto matter generally, na forum I Dey run come, I no really sure say most of the things wey I learn about bitcoin na for outside I learn am, most things na for dis forum I learn am. Forum don really try for me, if no be for forum here, most of the things wey I don sabi about bitcoin and crypto, I for no sabi them.
If you wan learn about bitcoin or other crypto matter for outside, some people go tell you make u carry money come, and d funniest part be say no be say those people self sabi like that, last last na still book dem go carry give u make u go Dey ready. But for forum here, anything wey u Dey learn for here na for free, nobody go collect money from u, and u go fit ask question for here self, and people go answer u in a way that you will Understand.
|