Bitcoin Forum
December 16, 2024, 08:25:11 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 28.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 2 [3]  All
  Print  
Author Topic: Info-thread: Translation of Useful English topics to Pidgin {mix images}  (Read 12036 times)
This is a self-moderated topic. If you do not want to be moderated by the person who started this topic, create a new topic. (3 posts by 1+ user deleted.)
sokani
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 714
Merit: 441


View Profile WWW
April 26, 2023, 09:22:25 PM
Last edit: May 15, 2023, 11:52:01 AM by sokani
Merited by hugeblack (4), GazetaBitcoin (4)
 #41

Translated Topic in Pidgin Language: De call for Julian Assange || De WikiLeaks Manifesto - Make all of us read am
Original Topic: The call for Julian Assange || The WikiLeaks Manifesto - We all should read it
Author: GazetaBitcoin




Maybe plenti pipo don hear about de name Julian Assange, but na only few persons know who him be, wetin him do and wetin him dey do now. From dis, na only few person who know why him be emblematic figure for de crypto space.

Dis topic na call for help, na him make I post am for the beginners and Help board. Na call to help Julian!

I bin don plan to write about dis topic for sometime, but for some reasons (de most important be say I no get time) delay am. However, another recent discrediting of de press (in one way or de other) come make me to write dis thread. Though de reason behind dis dey less important. Wetin dey important be say Julian need help!



De last sentence for dis topic na cautionary tale: "Make all of us continue Cypherpunks' work and dey fight for freedom!"

De Cypherpunks group bin emerge initially for 1992 from Eric Hughes, de author of "The Cypherpunk Manifesto", John Gilmore and Timothy May, de author of "The Crypto Anarchist Manifesto". From one former meeting for Gilmore office, dem come create one mailing list, under de name of Cypherpunks mailing list.

During dat time, odas join Cypherpunks fight against de state as dem dey surveil de citizen. De number persons bin reach more dan 1000 contributors.

Julian Assange bin dey part of de group between 1995 and 2002. Him get brilliant mind wey odas bin observe. If May, Hughes or Gilmore bin focus more on "algorithms for people", for digital cash and for public access to cryptography (for de era wey NSA bin dey fight wit all their power against dis), Assange bin get different principle: “Freedom of information na respected liberal value."

The WikiLeaks Manifesto, one document less known, unfortunately, e contain oda words of wisdom from Julian: "Only reveal injustice person fit answer; for one man to do anything thing intelligent him suppose know wetin dey go on."

As Gutenberg printing press bin surface for 1448, wey come lead to Printing Revolution, elite power over classified documents come dey reduce constantly. Dis na one of de first form of information decentralization. Julian Assange take am to a whole new level.

And dis one happen after de launch of Wikileaks, in 2006.

"I grow wit de understanding say de world wey I live na one wey people dey enjoy some kind of freedom to communicate wit each oda in privacy, without pipo to dey monitor am, without pipo to dey look into or analyze am or judge by some shadowy figures or systems any time they talk anything wey dey travel through public line." - Edward Snowden

I dey reason de same way as Snowden, and even more: I dey try to help am by recommending where him go fit settle and where him no fit settle for him new life after him betray de govern; Assange published thousands of classified information from all parts of de world.

Him connection to Bitcoin?, Some fit as.

After US govern bin come initiate a financial blockage of WikiLeaks accounts, Julian come realized de potential of Bitcoin and come dey reason to accept de new cryptocurrency as a way for donation. De idea bin put BitcoinTalk on flames dat time:

"Bring am come", as RHorning bin emphasize.

However, Asange continue, ""Satoshi Nakamoto", de pseudonymous inventor of Bitcoin, bin respond: "No, no "bring am come." De project need to grow gradually so dat de software fit get strength along de way. I don appeal to WikiLeaks make dem no try to use bitcoin. Bitcoin na small beta community wey dey very young. You no go get any beta thing oda dan pocket change, and de heat wey you go bring go likely destroy us at dis stage."[...] Six days later, for 12 December 2012, Satoshi come famously disappear from de Bitcoin community, after him post dis message: "e for dey nice to get dis kind attention for any oda context, WikiLeaks don kick de hornet net and de swarms dey come towards our direction.""

As a deep sign of respect for Satoshi and for him work, as Asange bin talk (for de previous mentioned link), "WikiLeaks bin read and agree with Satoshi analysis, and come decide to stop de launch of bitcoin donation channel until de currency don dey more established. WikiLeaks later launch their bitcoin donation address after de currency major boom, for 14 June 2011."

A sign for respect wey na rara avis nowadays.

Julian rely on Bitcoin certainly no only help WikiLeaks: e also help make Bitcoin to dey popular; e raise awareness about Satoshi creation; e bring more and more people to de path wey Satoshi open.

Wetin happen next dey well known dan de above mentioned history. US government start to dey hunt Assange for 2011, and in response, Julian come manage to help himself by seeking asylum for de Ecuadorial embassy for London. Dem come grant him request for 2012. However, him stay for de embassy bin no dey easy - among many oda things, him bin no step outside de embassy until 2019(!), him bin dey live almost like an inmate. Between fabricated accusation of sexual harassment, wey dem drop after years by the Swedish govern, and him continue work for WikiLeaks, Asange also try to keep his moral and do him best to avoid extradition to the US, as him dey aware say if dem carry go there na death penalty or at least 175 years behind bars.

Unfortunately, for 2019 Ecuador come end him asylum, for reasons wey dey more or less ridiculous, but e dey almost clear say dem force de decision somehow by oda secret agencies or by oda governs.

As I dey write dis thread, Julian trial for extradition don start. During de trial, him dey stay for prison.

As I bin talk recently, for one of my previous topic,

De fight for freedom of speech, for privacy and to dey render governs irrelevant start long long time ago. Now e dey our hands.

E dey our hands also to help Julian. And to help am mean to help freedom of information!

I no go talk how to offer dis help, I dey sure say everybody know, or atleast, get small intuition about am.

Time dey for debate and time dey for action. Now debating time don pass.



Issues to note:

I also recommend make una read de following:
- Nils Melzer's The Trial of Julian Assange: A Story of Persecution - The shocking story of de legal persecution of Wikileaks founder Julian Assange and The dangerous implications for The whistleblowers of The future
- Robert Manne's piece of art The Cypherpunk Revolutionary Julian Assange
- The Most Dangerous Man In The World: The Inside Story On Julian Assange And WikiLeaks, written by Andrew Fowler
- Cypherpunks: Freedom and the Future of the Internet, by Julian Assange. De book na discussion between Julian, Jacob Appelbaum (Tor developer) and Jérémie Zimmermann (co-founder of La Quadrature du Net)
- Underground, by Suelette Dreyfus & Julian Assange. Na fascinating book about de rise of Australian hackers and phreakers from 1980s, including de early activity of Julian Assange, which by dat time dem bin know am as Mendax.
- When Google Met WikiLeaks, by Julian Assange
- The Unauthorised Autobiography, by Julian Assange.

Besides de following movies dey parts of a most watch category:

Ithaka - na documentary wey show Julian struggle to avoid extradition to de US
Na WikiLeaks very own documentary - full movie
Risks - Na WikiLeaks documentary, directed by Laura Poitras (a friend of Julian Assange) - full movie
The Fifth Estate - Na great movie about WikiLeaks
We Steal Secrets: The Story of WikiLeaks - Na yet another documentary about WikiLeaks
Underground: The Julian Assange Story - Na another movie about Julian, wey describe him early career.
GazetaBitcoin
Legendary
*
pizza
Offline Offline

Activity: 1918
Merit: 7695


Fully-fledged Merit Cycler|Spambuster'23|Pie Baker


View Profile
April 26, 2023, 09:52:23 PM
 #42

Thank you dear Sokani as you translate one more of my topic! Great job! Dis way more and more pipo go dey aware of de struggles of de poor Julian Assange.

Dis theme na dedication to Cypherpunk, to freedom of journalism, and at de same time, de material try to bring out de unjust justice wey Asange bin face. And all dis because he want talk de truth, de whole truth and nothing but de truth.

Similar to Ross Ulbricht, US government bin hold Asange as an example. At de same time, none of de oda journalist wey cooperate with am face similar allegations. No New York Times journalist wey secret agencies don ever persecute. No Der Spiegel journalist wey US don accuse of spying. No Guardian journalist wey dem don hunt. And all dis na de biggest names for de press wey collaborate with Asange. Instead dem bin hold am as role model.

We go only fit hope say him go dey finally free again...

█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
e
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████████
████████████▄███
██▐███████▄█████▀
█████████▄████▀
███▐████▄███▀
████▐██████▀
█████▀█████
███████████▄
████████████▄
██▄█████▀█████▄
▄█████████▀█████▀
███████████▀██▀
████▀█████████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
c.h.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
▄██████▄▄▄
█████████████▄▄
███████████████
███████████████
███████████████
███████████████
███░░█████████
███▌▐█████████
█████████████
███████████▀
██████████▀
████████▀
▀██▀▀
Fiasem20
Full Member
***
Online Online

Activity: 364
Merit: 101


View Profile
August 17, 2024, 10:48:32 AM
Last edit: August 17, 2024, 02:35:26 PM by Fiasem20
Merited by BlackHatCoiner (5), Moreno233 (1)
 #43

Translated Topic in Pidgin Language: [Newbies] Read am b4 U stake an address
Original Topic: [Newbies] Read this before you stake an address
Author: BlackHatCoiner


To stake address mean sey u suppose know wetin u dey do,if u be newcomer. Also,
Signatures and their capabilities are complicated.

Nai make I yan dis thread; make tins no con hard for newcomers and make dem sabi wetin dem dey do. If you bi newcomer wey know why e dey necessari to stake ur address and how dem dey do am(wit wat softwares). I go focus on how u go take stake am in a way wey comma no go dey and na ur brain u go use.




Staking.

Wen u don stake ur address, u go do am so dat if need dey wey you go prove sey de account na ur own, u go fit do am. Di wahala bi sey most times, pipo dey use mechanical method dey operate well well, na becos sey dem no sabi wetin dem dey do. If u neva stake address b4, just jejely visit de koko thread den make u drop ur address wey ur non-custodial wallet generate, na like dat:

Code:
This is my address, please quote it: bc1q0fc0e3e0zpve6qg2fw2tfxwnvsw5p4kae3u2yx

Need no dey for u to bring message wey already dey signed from dat address, becos we sabi am at de moment, de owner wey get de account don stake deir first address. E dey veri obvious sey na deir own weda dem sign message or dem no sign.

E dey advisable sey make u use address wey dey unique, especialli de one wey neva receive Bitcoins. U go fit do am, sha, but e go harm ur privacy. E go beta make u choose address wey no get connection wit ur transactions.


Signing.

Wen dem go ask u to lap di proof sey na u get de address, u go sign and u go publish di message. [dis one na how] [dis one na why]

Code:
-----BEGIN BITCOIN SIGNED MESSAGE-----
I am BlackHatCoiner. Today is 08/11/2021 (15:01). This is a proof that I still own bc1q0fc0e3e0zpve6qg2fw2tfxwnvsw5p4kae3u2yx.
-----BEGIN SIGNATURE-----
bc1q0fc0e3e0zpve6qg2fw2tfxwnvsw5p4kae3u2yx
Hyi7C7hHSBN3cVV0Q3NF7poPFox49Zehs0z2WRWEV1x/ZdJUpcGWT5UUhWZylZ3SNFn0DU6ITNZgqu0goqY2C8s=
-----END BITCOIN SIGNED MESSAGE-----

If u wan stake anoda address, you go need to sign a message from ur old address and e go contain ur new address inside am:

Code:
-----BEGIN BITCOIN SIGNED MESSAGE-----
I am BlackHatCoiner. Today is 08/11/2021 (15:01). My new signing address is bc1q2mxckeclkndcu68m5v7qhf6guwakn6en96s2mc.
-----BEGIN SIGNATURE-----
bc1q0fc0e3e0zpve6qg2fw2tfxwnvsw5p4kae3u2yx
IChf1za07r3UTa2CGlU4mVpQaHlVAK3N8yK3ViASvfbtbstLNX60TSfFml+9VAR4czTMP9Y8+yyDkB+XwZmPRlM=
-----END BITCOIN SIGNED MESSAGE-----

Note sey reason no dey at all for u to sign a message from di new address, na desame reason wey no need to do am for ur first address. We sabi am at de moment, u don sign message from ur old address, we don reason am finish sey truli na u, and u don choose to stake anoda address.

Dis one fit happen for many reasons. Pesin fit becos of fear of de old casala. If na dat kind case, den u go bring ur signed message wey onli de owner of di account go fit provide a signature from de new address and no from de old one.


Quoting and Verifying.

Now dat one na dey optional, na for only pipo wey wan help for de quotation and verification of di thread's addresses.

For some users fes time dem dey like stake deir address alongside wit a signed message, if dem feel sey to stake onli address no do dem (I don sha explain am for up why e dey sufficient). If de user don stake a signed message, u go need to verify am.

IF de message no fit dey verified, den e mean sey de user neva provide signature wey dey valid. Dat kind case, u go reply dem sey dem do sometin wrong durin di procedure and wetin I mean by “reply” I mean sey u go quote de whole message just in case dem don edit deir post. If na de fess time wey dem dey try to stake address, den no palava. Dem go learn las las. If dem don stake address b4 and dem wan stake anoda one, but dem no fit provide u message wey dey valid from the previous address, den di mata go con dey look suspicious.

If dem don send u signed message las las den na like dis e dey look like:

Code:
-----BEGIN BITCOIN SIGNED MESSAGE-----
I am BlackHatCoiner.
-----BEGIN SIGNATURE-----
bc1q0fc0e3e0zpve6qg2fw2tfxwnvsw5p4kae3u2yx
H1kZ1IEa3WY1LOjsyj/5rWE1bjS7dzWXaPDsXFqK3zSUcYJvAcjAxGzZn+UDoIU7sDu+nTS+i4QF4eH4fXYnVzA=
-----END BITCOIN SIGNED MESSAGE-----

U go deny am flat and u go con ask for one wey dem no reach sign b4. To make sure sey di original owner no reach sign the message wey dem ask (wey hacker fit don take am from am), u go need to ask dem but no be wit gra gra make dem provide u one extra tin; time. If dem post message wey time dey, den we fit confirm de pesin wey get di account.

As for ur post wey quote de signed message:  E no dey necessary to provide link wey go carry the reader go website/image wey go confirm de message's verification.E get some users wey don create websites wey fit archive every post wey pesin don create. [loyce.club, ninjastic.space]



If u think sey wetin I don yan somewhere for dis thread wey no correct or e get where I neva yan and e dey important abeg tell me
Fiasem20
Full Member
***
Online Online

Activity: 364
Merit: 101


View Profile
September 09, 2024, 11:31:51 AM
 #44

Translated Topic in Pidgin Language: Anonymity & Privacy dey different
Original Topic: Differences between anonymity & privacy
Author: BlackHatCoiner

I don think am sey make newcomers know di difference between anonymity&privacy . Pipo dey like confuse dem or some pipo dey consider am sey na desame, but deir meaning no be desame. I dey like compare dem with Bitcoin each time make e dey clear.

  • Privacy
Privacy na when pipo get di abiliti to seclude information about demselves. In oda words e mean sey, na di right wey pesin get wey e no go fit dey subjected by unauthorized invasions like government's. For example, corporation go fit want make u bring ur personal details to serve u di appropriate advertisement. Google fit use Adsense take invade ur privacy; if u wan watch video or u wan google sentence about “Pets”, u go see things like  Pet Shops/Food/Toys whenever u dey find google ad.

In Bitcoin, dem fit invade ur privacy. Make we talk sey Charlie and Bob don receive 5 BTC from Alice for transaction wey resemble dis one:

1ALice...   10 BTC --> 1CharLie...  (5 BTC)
                       |  --> 1Bob...        (5 BTC)

Alice & Charlie don know sey Bob address na 1Bob[...]. E mean sey if Bob choose to send dis 5 bitcoins, dem fit track am down. Make I give u anoda example; make we sey if Bob wan get rid of all ehn Bitcoins dats ehn dey sell dem to exchange. He don choose to combine all ehn input and create one output.

1Bob...   5 BTC --> 1Exch4nge... (25 BTC)
16Uw...  2 BTC
1Ku8...   8 BTC
1HA8...  10 BTC

Now Alice & Charlie fit observe sey di signer of di address wey receive 5 BTC b4 na di owner of three addresses wit 2,8 and 10 BTC. Even if dem no reach succeed find dat di receiving address na exchange's, dem don already sabi am too much. Bob dey exposed and every transaction wey ehn dey make from any of ehn four addresses fit dey censored by pipo. In oda words e mean sey, if Bob don commit illegal activity from di 1Bob[...] address, dem go consider all of dem wit wetin we dey call “tainted bitcoins”, because sey dem be dey in di possession of a criminal. Even if sey pesin don make complete legal transaction wit Bob, he or she go fit dey censored. Pipo dey use mixers or/and mixing protocols to take enhance deir privacy.

Here na beta technical thread to read: [Education] Bitcoin Privacy and Anonymity


  • Anonymity
Anonymity na when di identity of a pesin no dey known and no technique wey dem fit use identify or reach di pesin. For dis forum, I use dis name take register  “BlackHatCoiner”, but if my IP don leak somehow, u go fit theoretically use technique take reach information about my identity. So,I dey anonymous? No. Example of anonymity wey dey happen for real life na free elections.

In Bitcoin, while ur address no dey reveal anything about ur identity, di block chain dey show transactions wey u make, di amounts wey dem transact and when dem transact am. If u wan buy something from store and u use input of 10000 BTC, di seller fit sha know how many bitcoins u at least get. So, na anonymous? No. na pseudonymous.




So, di concept privacy dey describe activities wey u wan keep dem for urself, privately. On di oda hand, anonymity na when u want pipo to know wetin u dey do', u no just want dem to know sey na u dey do am.

  • Anonymity na when u donate to a charity wey na cash u use.
  • Privacy na when u lock di door inside bathroom; no be because sey u dey hide anything, na u wan just keep di activity dere to urself.
Fiasem20
Full Member
***
Online Online

Activity: 364
Merit: 101


View Profile
September 19, 2024, 01:57:08 PM
 #45

Translated Topic in Pidgin Language: Blockstream Jade - na fully open source hardware wallet
Original Topic: Blockstream Jade - fully open source hardware wallet
Author: witcher_sense


If u dey prefer open source hardware wallets, den make u look dis new product from - Blockstream Jade.

Of recent, Blockstream deir team (Blockstream CEO Dr. Adam Back and Blockstream Chief Architect Lawrence Nahum) don yan deir new hardware wallet Jade wit fully open source hardware and software.

Dis wallet go support Bitcoin BTC and all Liquid assets of di Liquid Network (L-BTC, Tether (USDt), L-CAD, JPYS and odas).



Di hardware wallet dey available for pre-order and di price dey affordable.



Anoda information to add(Q&A from recent AMA on Reddit):

Q: Di WIFI in di MCU e dey disabled through firmware? U get plans to use WiFi for di future?
A: Di WiFI in di MCU e dey currently disabled but dem fit still enable am. Jade dey come wit two firmware variants, one na wit radio and anoda one na without radio. Di one wey no come wit radio no get di WiFi or BLE drivers to work. Jade ships wit di BLE firmware but e come wit BLE off by default.

Q: Jade PSBT dey compatible ?
A: Jade dey use wally wey get PSBT support. At di moment Jade dey support Green multisig wey no dey take advantage of PSBT. We dey plan to add to Jade single sig and PSBT support.

Q: Where dem dey manufacture am?
A: Na desame manufacturer like M5 Stack but a custom model for Blockstream.

Q: U dey sell device at-cost or at-loss?
A: No we no dey subsidize di hardware, keep am in mind sey Jade dey based on libwally which dey do most of di heavy lifting.

Q: Wetin be "server enforced PIN protection"?
A: Di mnemonic wey dem don  generate e dey immediately encrypted using AES256 and wit di use of a secret key wey dey computed through an encrypted and authenticated channel wit a [remote] blind oracle server, di authentication dey involve ephemeral elliptic curve Diffie Hellman exchange wit a server key wey dey known. Den di encrypted mnemonic dey stored on di encrypted flash of di Jade and e dey protected by secure boot [v2].

Di blind server no dey aware of di actual PIN nor e fit brute force am. Also di  blind server no dey associated wit di users account (e no dey associated wit di per user derivation paths)

If di PIN wey u enter dey incorrect 3 times di server and Jade both go delete di secret and e go require a from scratch mnemonic restore on Jade.

Di companion app nor any ISP/WiFi AP in di middle fit inspect di data passed between Jade and di oracle, e also dey able to tell u if di PIN dey correct or wrong (oda dan potential timing attacks). Di oracle dey available through Tor and open source and in di future users go fit dey able to run deir own and point deir Jade to am if dem prefer.


Q: Dem fit use am wit non-Blockstream wallets?
A: At di moment e no dey supported but full support dey planned. Currently e fit work sha but e go require u to confirm change manually and e no go enforce single sig path anti-ransom checks.

Q: Wetin make u choose to make dis device?
A: Di koko experiment na to porting libwally to esp32 and na base on di [PocketSprite](https://pocketsprite.com/) but most of di development occur on any of di easy to find esp32 boards and den on real Jades.

We think sey di market get beta hardware wallets but we feel sey space dey for sometin wey dey a bit different, wit some different design decisions and feature set. Specificalli we wan experiment wit Liquid features as well as advanced bitcoin features.

Q: How di security model dey compare to Trezor, Ledger, Coldcard?
A: Jade no get secure element so dere's dat.

However e get secure secure boot + encrypted flash and as per prior answer e get a blind oracle enforced PIN. Dis dey act almost like a remote 'secure element'.


Q: How we wan take define a “hardware wallet” – abi make di definition involve Internet-connected devices wey dey communicate wit servers?An airgap dey important or na just security theater?
A: Hardware Wallet get thinner surface of attack if u compare am to ur average internet connected laptop or mobile phone. Di both wen e come to di OS stack as well as radio/network.

For maximum security u wan avoid radio all togeda, however den u no fit use hardware wallet wit iOS. Well unless u wan use di camera, which na sometin we dey work on (e dey work but e require some improvements)


Di links:
https://store.blockstream.com/product/blockstream-jade/
https://blockstream.com/jade
https://blockstream.com/2021/01/03/en-secure-your-bitcoin-and-liquid-assets-with-blockstream-jade/
https://github.com/Blockstream/Jade
https://www.reddit.com/r/Bitcoin/comments/kqgehd/were_the_blockstream_team_and_we_just_announced/
https://twitter.com/Blockstream
https://www.reddit.com/u/adam3us/
https://www.reddit.com/u/bitfast/
Pages: « 1 2 [3]  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!