I tried to find out how their p2p works but I was unable to do that to satisfaction, I will appreciate if anyone among us can let us know about that
No bother, the site na useless something and I no go recommend any body to use am for any trade, e dey operate like most centralized P2P but there own matta worse as the place is full of scammers while the platform itself get as e dey be. The reviews online worst and this jo fit be targeted attack as I believe na just victim airing their anger.
Na dem remove d cash with one reason wey dem give wey I nor fit remember again sef. The more than 48hrs stress wey dat thing cause me nor dey funny at all. I think d cash involved then was around $250 sef.
Dem take centralization to another whole level atleast platforms like Binance wey dey centralized no go touch your money unless dem dun see every reason to do so but just as you explain na so I dey reason everywhere as I try do small research on the platform. No be today I dun sabi am but I never use am before and thank God I no do. Roqqu no be am at all and thanks for the thread Abge as this go help others get information on this site say no be am even though no be ur initial intentions.