U knw one tin wa dey tire me, na dis global market way dem dey call us. E dey always giv me d impression say, dem jst wa dey reap us on a steady nd e dey swt us 4 bodi. Na wen we cef go dey produce nd do Nigeria. Dis no really b at d Elon somtin o bt, we nid somtin way go b our own, e go dey work 4 our nation nd Ord nations go lik import am or get d service too nd not jst 2 d send raw materials commot 4 we naija, only 2 buy am bck as finished product.
Competition. Increase in quality service. These ones na some of the good thing wey starlink thingy go bring for we contri. From wetini read, e be like say the thing dey expensive for common man o. Like the people wey fit benefit now na people wey hold better bar because 19k per month nor be moimoi o. And also from wetin I understand, e go still take some time before we fit use am for our mobile devices.
I no dey see any plenty competition 4 here o. D least dem go fit do na 2 improv dere services nd dat na MTN. Glo way jst lik advert plenty nd dem no dey get network.
Anyway, I try read watin dey dere nd dat #19k way u put eh, e pass o. Na $43 I dey see dere nd dat na lik #32k monthly sub. E high no b small my broda.