...the CBN’s monetary policy reforms are not expected to exert a fundamental change on the Nigerian dominant vote-buying culture. While it might minimise the use of the local currency for transactional politics of vote-buying, the policy is unlikely to stem the entire gamut of the thriving vote-buying “industry” in a heavily dollarised liberal democratic milieu as Nigeria.
To understand am better. Make I ask, which currency wey PDAPC(PDP and APC) been use during their presidential primaries to take buy key electoral officials, delegate electors, voters? Na Naira or na dollar?
This vote buying issue nah primarily from the voters nah the vote buying really the take place pass compared to buying vote from officials. No be officials the do the thumb printing for election ground rather na the electorate like you and me wey go queue up for line to vote. So you no fit come tell me say that day na dollars them go dey share for electorates for queue , just like in recent times Dem never ever share dollars but naira, so if we look well well we go see say this new naira note policy go stop plenty nonsense wey politicians been dey use money do for election ground. Because it go dey very rare and hard to see politicians com d share dollar for election ground say mk people vote him party.
Na how much dollar him wan share for each of the polling units to each voter? Even sharing of dollar sef go cause confusion cos many persons go say na take dollars d.em d com share as Dem no know which one be fake or original. So any how it be, the monetary policy go really stop plenty nonsense for this election and it's clear.