For those still having issues here, I heard OPAY is the new boss in town, they are winning grounds when it comes to money transfers and other financial transactions.
Na so I hear oh, I dun download the app myself and wan open account with them ASAP. Before I think say na Kuda go strong for this period but e belike their high number of customers dey worry dem because their transaction come dey hang anyhow. Today self dem be get small network issues as their network been dey hang. All the bot I dun enter in the last 1 week dey always recommend OPay and na dem dey use this services pass so I no doubt their judgement.
As for the USSD code, you do well to highlight dem all but we dey the internet age wey be say anything wey you need dey one click away. With Google person fit get any USSD code him dey find but nevertheless, I appreciate your good thought towards the members of this community, keep it up. As for Bitcoin easing the cashless policy stress discussion, I doubt anybody dun benefit since e no dey very common to use Bitcoin directly for the country. Mainly men need trade am to Naira first before dem fit spend.