Good suggestion, nothing bad to try am even though I no support the idea fully, e no stop the board from trying new things all for the sake of improving the board both in quantity and quality.
No be bad idea really and no be bad thing if we try new things, d most important thing be say make e dey quality. If we try am see say e no dey work then we fit stop am.
Whilst i agree with wetin Charles-Tim been dey suggest, but on another note, do we even need to be translating topics from English language to pidgin, the truth be say everyone of us sabi read and write in English, some dey better than others, but the fact be say everybody for here understand English pass pidgin, especially when it is written and not spoken, maybe in speaking some people go understand pidgin better, but i dey see as many people dey write their pidgin for this local board and e dey very incomprehensible, but when i see dem write English on the English boards, i dey understand their points perfectly.
No be lie wey you talk. Reading in English dey easier than pidgin, but why we dey translate this topics no be only just for merit sake, also na to get that special filling of fulfillment say u dey part of or contribute to something beautiful. For instance, some of our ogas wey don hang boot for de translation mata, after some months or years wen dem stumble on de topic, dem go just smile and be like... Wow so I translated this topic, dem go just get some sorts of joy or happiness.