JUST FOR FUN
Abeg who get food for house give me location make I come chop.
I hear say all of una chop pizza for forum pizza day, abeg come give me my share for here.
Me I get food ooo but I don’t know how u wan take reach myself because d amount wey u go spend before you reach my side go pass Wetin you go come chop for my side ooo. We no fit share pizza for forum now, if you wan chop pizza you go need locate me, and d way things be now, like say everybody go dey need stay him house ooo, you no fit commot anyhow again.
I create this thread so that we go vibe, gist us how your side dey be for this season, fuel price don add and every order things don high too.
Share with us how you dey cop.
Make sure say wetin you want talk funny oo
na cruise thread be this.
My guy e no funny now ooo like say d lock down wey dey 2020 na play, na now we go enter another lock down, now wey fuel don increase nobody dey commot anyhow again ooo, everybody dey stay for house now ooo. even people wey get two cars for house before don dey sell one because of fuel, d once wey get 1 car don dey sell d one car dem dey buy bike, fuel don do almost 3x now, anybody wey no get important place to go no dey commot anyhow again ooo, everybody dey seat for him house now.