My country people in as much as una dey apply caution
make una no too take this SEC Serious, because Futures, M. Futures spot and P2P still dey go on smoothly, No be today SEC don carry out such attempts in USA,China name them.
SEC go just dey operate on policies wey no they ever work, and I believe say Cz dey really work underground to resolve all this issue.
wetin una think about this current ban cause I know say many people for forum wey dey use that platform (binance) go don dey panic already?
How u dey take create ur threads. You go create thread finished without making comments there, you go open another thread again with the same topic and the same content. So u no fit use this one make comment for di other thread? Do you know that dis is very serious offence in the forum at large? This spamming. If report na banning straight. Please try to maintain nd read di local rules and the forum rules.
Well you don try to point out things for the user but the truth be say we dey over do our things and no matter how hard we try, we can't be like the white.
Why not see this thread as a translation of his original thread in the economics board?
I've seen people translate works from other languages back to English and from English to other languages , does that also mean they're spamming or breaking any rule?
@Agbe make we dey try dey kind with this users and rather than make users feel bad, we can encourage them to do better privately and not make them feel they can't survive here.
@Youngkhngdiddy abeg try dey check for similar threads before you create threads as the board dey try fight hard to keep spammers out of the board.
I went through your profile and you're doing well. Please increase your quality and also learn to accept criticisms and build from your mistakes and corrections as that's the easiest way to grow and make meaningful contributions to the forum.
Goodluck.