then I asked how, she said yes now na yahoo boys dey do bitcoin and I no go like put body for wetin them go scam me, it was so funny that I laughed, and later began to correct her statement.
Na Wetin plenty people wey no sabi about bitcoin dey talk ooo, dey don put am for mind say na yahoo boys dey use bitcoin and if dem put their money their, e don go already be that, but i no blame them Sha, Ponzi scheme don plenty now and d way country hard now, e dey painful to lose money now, and all those yahoo boys, if you see them and you ask them Wetin dem dey do, dey go tell you say na bitcoin dem dey do na y most people wey no sabi bitcoin dey think say na yahoo boys dey use am scam people. And if you tell some people say bitcoin na currency dem go talk say dey no fit put money for Wetin dey air, something wey dey no fit dey see.
I created this post because I know cryptocurrency is vastly gaining audience around the world but there are many left behind who doesn't have idea about it, most of them due to ignorance have been scammed on wrong investments by bad actors,
Bitcoin is being used to scam now, dey don scam plenty people and all na bitcoin investment dem call am for those people, so people wey don fall for d trap before, even if you try explain bitcoin investment give those people, dey no go every believe you because they go talk say na another pattern you dey carry come wey u wan use scam them.