My G. This matter wey you bring here na very long matter o. Government naim be our challenge oh[/b], according to my analysis Nigerians dey hardworking, talented and educated. Nigeria matter just be like family were eldest son get driving job and instead of him to give his younger brother wey Sabi drive him go force himself to do the driving job were ass him no get the skill. wetting you think ft happen? If care is not taken him go get accident to distroy the future of his employer.
Make I make you understand say na the bad governments dey make us dey hard working and talented and most of our talents are been learnt and no be say we dey born with am. The learning process fit no dey intentional but na wetin dey happen to us be dat. Look at other parts of the world wey their government get better responsibility, dem no get our level of hustle (wey we dey call hardwok) and dat one na because say the government dun provide everything for dem finish. If Nigeria governments was better we no go dey get the hardworking traits wey we get for the country but dat one no be excuse for the surfer wey dem dey surfer us and they thief our money for their personal needs them.
We Nigerians just be lik iron steel in a furnace under the craftsmanship of a goldsmith such kind of steel dey com out strong and well carved e dey even hardly rust or bend and this goldsmith for this analogy na hardship aka Sapa/Shege.
And if luk down well we go see say for Africa and most parts of the world Nigerians nah get the best brains despite how hard the country we com from dey on us. Like if you fit survive for this naija inno get anywer wey you no fit survive. Na just unfortunate tin say we get bad leaders wey no get sympathy for the people dem claim to lead in guvonment.
The country don turn evrybodi to risk taker and if you sit down say you no wan take de necessary risk you go just in ur sleep like that cos nobody dey com to your saving if you never try to first save yourself by taking risk.
Since we no get de privillage to com from country wey de government don provide every essential social amenities keep to make life sweet, we den no get choice but to take the risk wey dey available.
If you survive you survive, if you die all die nah die.