I just dey go through the Bitcoin forum discussion (Meta) I come see one of our senior man for this forum him send application for merit source on behalf of the Nigerian local board. I want bring am to some people notice wey never dey informed.
Wetin come surprise me be say the kind support the community dey give this our senior man by name @Igebotz dey sweet cos everyone dey in support and I sure no be only our local board members.
Normally with everything him submit for the application dey 100% correct and no doubt from any angle, now I don understand say e dey really pay when we dey always abide by the forum rules and regulations.
This na the link to the application…
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5462533.msg62664902#msg62664902We pray say very soon dey go give positive feedback to this our senior man application.