My country people I greet unable oooh, I come across this post, way say Binance go stop Busd trading from 2024, and so Binance have actually started asking there users to stop support Busd and that there services will be phased out until Paxos will complete the acquisition of Busd by February 2024. so I say make I share am here for those way nava they aware and get small Busd for account so them take action immediately.
You do well and this news dun dey for the media for sometime now as e get when the SEC been dey worry Binance based on this their BUSD mata and e belike dem been call am an unregistered security. Binance come say no be dem self dey issue the stablecoin even though e dey bear their name. The mata come out around February this year and maybe this na just steps wey Binance exchange dun dey take to protect their customers and also to comot for the SEC lawsuit wahala because if dem prove say BUSD na security and Binance exchange still dey parole with dem e fit pit dem for big wahala.
The news is not true as i see it, if the people were aware of these, all investors will withdraw their assets from it, secondly, BUSD is a currency that I don't think can easily go down line that, though if something like this should happen, then we should first expect much of this from Binance exchange itself than the coin first, which regulations will keep Binance running but BUSD down, i don't think it will stop or they would have announced it by this earlier.
The mata na true and Binance been dun dey offer the swapping BUSD to other stablecoin service. Also I been dun dey get notifications of BUSD pairs been delisted from Binance exchange since and other services wey person fit do for the exchange with BUSD has been slowly removed. Binance dey take precautions make e no cause price to tank due to panic as any harsh moves wey dem make go fit affect the market and they'll be held responsible. Already Binance dun send notifications say;
Binance Encourages Users to Convert BUSD to Other Stablecoins Prior to February 2024 and this one na information directly from the official Binance exchange support page.