You no lie if Bitcoin becomes legal tender for Nigeria, e go attract so many investors and more employment opportunities go dey too but e go make most of the youths wey get Bitcoin knowledge to shift their dependency on the help of the government which is the major reason why government is against the acceptance of Bitcoin as a legal tender in the country. Make we just dey do our hide and sick kind of Bitcoin usage for the country until things change for better.
No be lie you talk for here. Already Bitcoin is seen as a threat by them and to come totally comot the small one wey dem dey use deceive the youths especially when it comes to election period of ensuring massive job opportunities the moment them enter if them accept am as legal tender go be much of a challenge. Wetin make me feel say these oga dem get say on the matter of Bitcoin nah be say as their businesses dey here, e dey also help contribute to the GDP of the country so I no sure say the president go easily manipulate them. Secondly, since we naira dey drop rapidly, although now e don dey get small head, them fit suggest a pairing, so Bitcoin fit act as buffer but the question we need answers to nah, them go gree let selfishness free dem unto say them no dey use the naira much and do am for those wey no so get access to the president ear?