Just checked the thread in question now, me self nah part of the people way comment for their, Watin I observe for Watin happen with that users be say, eh rush go comment for their I believe say in no read through the thread finish, the person just use the title of the thread carry make in own post, and eh be like eh they in a hurry to finish am enter another place, and eh be like the person also no they use the BTT supernotifier because if him they use am, eh for no say the tool no get any effect for person account and nah just notification bot eh be.
Thank you say u carry this one come here, the person way dy in question I believe say eh don check the comment and in go don see say eh don fuck up by now, and as you lock the thread kwanu hood before people way like to carry matter for head go go choke mouth.
That is why its very important to always read through what people are saying or even devote time to read at least what the op is saying will really help stops some forms of blind comments, like this as i see the post even self shame catch me onto say him go say na 9ja people na so dem dey comment and him dey do anything for forum him fit no pick that user onto wetin him just see for the comment. I believe him fit even pm their manager self for that comment.
The bottom line be say settle down read post, comprehend wetin the body of the message dey take before you rush go comment on something I think I been talk something like this before but them reply say e no mean, say no be everybody get time to read the whole op before commenting. Before me been dey do am but when I noticed say I no dey too flow with the whole things I begin reduce the way I do things here then I come bring mind to dey read post before commenting.