One thing wey make Nigeria power supp;y no fit stable na because of corruption from the President down to the power sector and businessmen. Shey una know say na crude oil, especially petrol na him these politicians, especially presidents and the minister of petroleum and every other body wey get access to Nigeria wealth dey from thief. What I mean that petroleum is what everyone eyes is into in which they are stealing from to enrich themselved quickly, because ever since Nigeria discover crude oil na e the abandon other natural resources because big money dey crude oil.
Back to my story, this na e make the government no go ever want make steady light dey so that more people go dey buy petrol for usage, so that them go fit dey get their own cjoping from selling larfe quantity of petrol. Oya make una see now, as Tinubu enter na fuel subsidy him commot first, so that that percentage wey the country fey use pay subsidy, he go fit put am for pocket, why Tinubu go come want make power supply steady for here.
Also una know say some people dey in charge of exporting the crude oil to be refine for foreign country, those people too no go want make steady light sey the country because of the benefit wey them dey benefit from the business to export, refine and bring back to the country for usage. Lastly, na this businesspeople wey dey go import generator, them no go like make steady light dey because people no go nuy generator again and things go spoil for them. I believe say this filling station owners too dey follow for this bad work because I go remember when Nigeria go get strong match to play, when the time just reach for the match, before you know Nepa don take light. Do many things involve for why light no fit fey stable for this country. Na only God fit help us to get 24hrs light like Ghana because is like this people don plan to keep the country as black as their hearts. This na why them no won give us steady light so that them fo dey use buying of petrol dey extort us, because if steady light dey the rate at which petrol dey sell fo fall drastically.
Hmmmm, Na true you talk o. The corruption here in Nigeria too much. Well, based on your analysis, I see sense for wetin you talk because all these variables wey you mention get interconnection with each other. The marketers, importers, distributors down to power holding themselves dey all run business and e be say all of them dey for power sector. Na for their own selfish interest dem dey work for.
You say big money dey crude oil I agree as you talk but the money wey dey gas big pas crude oil and yet we never hear government talk anything about the gas wey dem dey sell but only crude. I believe say all these brouhaha wey we dey see so na just to distract the attention of Nigerians from that area make we no know wetin dey happen there. Abi Na lithium wey dem dey use produce battery? Nigeria get am excess but we never hear government come publicly come give account for any of them. Abi Na the gold wey dem dey mine for north wey we know wetin happen few years ago till today anybody don hear anything about that one.
Our leaders dem dey collabo with all these vendors dey run their parol. As e be say dem dey for power, dem dey use their influence dey pave way for the vendors so that their plans go work accordingly and na the business dem dey do for long. Why this thing go hard before e stop be say na wetin don dey in existence for long now and anybody wey want to come stop am go jam big resistance and them go fight and frustrate that person. That is why I dey always talk this thing say e go hard before a genuine person fit succeed to be the president of this country because the power that be would never allow anybody to spoil their business for them.