Omor my brothers make una come see tori wey I carry come board today, NASA(National Aeronautics and Space Administration) don
dey plan for to build houses for moon just the way we dey watch for Hollywood fiction movies but this time around dem wan bring am to reality dem say because the moon get some kind of magnetic property wey dey pool things to itself say e go make the idea dey possible, and na 3d printing dem wan use take make the building. But dem still get some thing wey dey stand as treat to building houses for the moon, dem say the dust particles for the moon dey very toxic, but for me I dey see say that one na just 10% of problem wey dem get because only oxygen for one day for this country na 25,26 thousand, before dem ho com talk about food and other things.
But that one no be watin dey make me fear, the thing wey dey make me fear na be say, all of us dey the earth and we dey see the wey the government dey handle virus wey spread across the world matter, if dem com package house for moon you no sure say dem go leave us to die finish for earth? Because the heart of men are desperately wicked l, even after the covid e get one video semina wey some Americans been dey do and dem talk say
by 2023 dem go reduce the world population by 50%. Just imaging how dem wan use take achieve this dream if no be to kill those wey dey exist?
If at all say by the 2040 dem don finally build the houses dem for the moon who know the kind of virus wey dem fit release upon us?