Would anything change from the point of crypto holders? Please share what you think.
For the level of guys wey dey hodl, trade abi sell btc, my brother nothing go change. The stuff go still dey as e dey especially for guys wey don tey for the game, I no mean newbie. I no go imagine say person go begin waka enter bank becos of btc or come begin use bank app on btc because if that policy happen bank go include btc on their app. E no go change anything, btc dey decentralized and no government fit come regulate the use like their fiat, no.
The thing wey Nigerian government fit succeed do na to go dey regular binance and other exchange and get access to persin document but to go mainstream regulation on btc, Dem no get the mussel. Dem self na follow follow so until the West come up with their template, forget nothing new dey happen.
Except e go just be say e don dey legal status for Naija and all man fit boldly talk about am, trade am, go bank discuss am, link your bank account to exchanges but P2P still go dey flourish well because guys no go still send government.