my country people, I just say make I bring this new as the thing really dey pain me Wella. the country matter don tire me and many off us don confirm say the country dey worst even more. just dis morning, as I come dey check news na e I see this one wey talk
say cooking gas now na 1000 naira per kg and go likely increase for some places to 1200 per kg.
Gas wey everybody see say d price dey drop before, now gas price don dey skyrocket again, Abeg Wetin go even come down for dis country wey we dey, things are just getting harder, people just dey suffer anyhow, gas wey we reason say e don dey come down, and I come dey hear news say e go even drop more, now gas is now sold above #1,000 some people wey don go rush convert there generator into gas, since dem see say petrol price don to go up, now wey gas don dey go up also, na make dem convert am go back to petrol back.
I no even sabi Wetin dis country need again, we don even pray to God tire, things are just getting worst, time wey we suppose stand up fight for our country, some people are still be deceived by the small change wey politicians dey share for them during campaign, because of money dey go still use there hand vote for the wrong person. Me I no even sabi Wetin person wan even dey complain about again, because complain no fit solve any problem.