Even most of the graduate when de complain say work no de or government no gree employ them, if you look them well you go observe say them be people when no too take there studies serious or them just focus on there studies and no add a single skill to wetin them go study for school.
If you carry school serious or u no carry school serious, e dey painful after all the shege wey person don see right from primary school level, make u come finish from higher institution make u no come get job, e no really make sense now, everybody must complain. But as dis country dey now wey level of unemployment/ underemployment dey increase, e go make sense say make everybody learn skill’s even if you dey school, at least if you graduate from school and anything no dey ground, you go fit start something with the skills that you have learnt, and you fit still continue to dey search for job if you want.
If you just born pikin for dis country, if d pikin just dey enter secondary, make sure say you find skills wey be say him or her go dey learn, because d way thing’s dey go for dis country now, anybody wey depend on government job go see shege.
I know some persons when de very good at writing but them know no say that one too na skill when de fit use get one or two money, there own na to use am for Facebook comment section take complain about how work no de for we country.
Some people good for writing but some of them no sabi d right channel to follow to dey use am make money, for dis country everybody dey hide where dem dey get money, we no wan help each other because people go dey reason say e go cast. All dis online courses wey dey, if you see d way dem dey put big money wey dem go talk say make u pay before dey go teach u, person wey never see money chop na him go get that kin big money to pay, and u are not even sure if the person is real.
Make I even use dis forum as example, people dey dis country wey sabi about bitcoin and cryptocurrency well and some of them no get better money to invest or to dey trade, but they don’t know anything about forum. If you get account for here and u fit rank am up, u fit use am enter signature and something go dey commot, but na few people sabi about forum.
If you dey successful, no dey reason say other’s dey lazy, dey fit no get d opportunity wey u get, if some of them get similar opportunity wey u get, dey will be doing better than u, no dey reason say because person sabi write and him no dey make money with am, e no mean say d person dey useless.