For those wey like to read more you fit get the link for
HERE.
This na some sort of a very good news on a normal level, but right now, this one come be like say na medicine after death, as we all know the kind of country wey we dey live say na one wey defile every the law of gravity wey talk say, "whatever goes up must surely come down", e come be like say this law no dey work for Nigeria as whatever don go up no dey ever come down again.
So, how sure we won dey say this things wey them list for this write up go come down again, shebi the owner of Bua cement come out con tell we Nigerians say Bua cement price don become #3,500, but this morning, just a few hours ago, i bought same cement for #5,800 naira per bag.
Me no dey look or dey expect anything wey don go up for Nigeria to come down again ooh, wetin i dey always dey pray na make God bless me financially, make i become become extra multi-millionaire, billionaire self, so that buying anything won't be a problem to me, no matter the cost.
And bros or sis, abeg, help us check the link wey you share above, the link no lead to anyway, rather, na download link of wetin i no know na im you paste there, when i click the link, the "save as" dialogue popped up on my computer, e no mention or show wetin e dey ask me to Save as. abeg check the again and post the correct one.