So this thing come made me the wonder say how can a very popular actor who have put smiles on people's face for over 20 year can afford to foot his travelling and treatment arrangement for such a small amount of 7 million, which will result in a public donation.
To begin with, I go talk say na lack of retirement planning the cause all this things, Mr ibu no plan wey for him retirement and that's why he's still hustling at the age and don't have enough to take care of himself. Also this old entertainers weren't been paid the best fees back in the days but still their money been get small weight wey be say if them be invest am well dem for dun get wetin go help dem in situations like this. If him been get health insurance, dem for dun take care of him bills for am but our entertainers no dey invest wisely for the future but only to dey live lavishing lifestyle now and come dey beg for future to use survive. Mr ibu was one of the biggest name during his reigning days so him supposed use him head get investments and he won't be disgracing himself now begging for money but e dun happen be say e dun happen so make we learn from his mistakes and plan well for our future which involves emergency like sickness and other things by getting better insurance.
And a young girl who is bearly known for getting such an amount of money that runs into hundreds of millions within a short period to splash on such a home for herself, and her case is one among many of her colleagues who have bought SUV cars worth millions in the same movies industry.
Na her own time be this and if she no plan her future well she go dey like Mr ibu dey beg for help in the future, also make we know say this modern day entertainers get so many opportunity passed the olden days one because many business opportunities dey now. This guys are into brand deals like influencing wey dey pay dem pass those acting money, they have monetize their social media and dat one dey pay dem too then also dem get their own business wey dem dey use their popularity promote and e dey give dem better choppings and some get other side hustle wey no get anything to do with entrainment (selling of their body and so on) and since dem dey popular, men wey hold bar go wan roll with them and sponsor their lifestyle just to get their own fame too. The Koko be say the new modern day entertainers dey use their opportunity well to gather funds.