Last weekend was very massive in the gambling world especially when E-money posted his bet between Chelsea and Arsenal. I know a lot of people followed him to play the game because it was trending on Twitter. I can only imagine how many new converts will join gambling the coming weekend.
My advice na say make we use our head o because gambling no be anybody mate. People wey dey celebrate their winning fit don dey loose dey come since, maybe their own time just come and they pick major. There is no easy wat to wealth so make we gamble responsibly. Thank you once again OP for this post because I know say plenty Naija guys dey game even on low key.
If me wan bet this weekend, I go avoid the games of those wey win last week because them fit use this week pay back some of them money them. I no wan follow pay beck wey me no owe.
I no just understand how some people brain dey work, especially those gamblers wey dey gamble blindly simply say one celebrity or social media influencer stake game and post, them go just rush follow am like werey. Although sometimes, e dey actually they work in their favour but e no mean say na so them supposed carry follow up gambling.
Gambling itself no be be bad thing, na just the way some people dey carry follow am, because say you see where person carry 5million naira take stake game, your mumu button activated say na e be the surest game, then some people go carry their hard earned money go through for the same stake without even thinking twice.