my country people, greetings. so recently a friend of mine who still dey into cryptocurrency but not Bitcoin con dey gist me about all these online miners and airdrop matter, and how so many of them don actually pay am. he still tell me say some two still don turn out to be waste of him time and till date, all the coin wey e dey mine for there just dey useless for wallet. As we dey talk, na e con show me one miner like dat wey e dey mine for over 7 months now. d miner dey mine eth and talk say until e don mine reach 0.005 eth before e go fit withdraw d coins go wallet. e show me say miner don finally reach d specific amount but when e con dey try withdraw, Dem con dey tell am to deposit 0.005 eth first before e go fit withdraw any money from d Website. as I see dis wan, I just smile because even him self know say na scam.
dis one con make me remember say back in days, there were many off these free miners wey still dey pay person. but now na scammers na come dey run all off them. how you go pay 0.005eth take withdrawal 0.005 eth. it's obviously a scam attempt any one wey mumu try pay money give such website, e money don go. I just say make I bring d matter con our local board as I see say e go dey help full to many of our members here wey still dey new. as I don first write before for one of my thread.
Things wey people dey do wey fit put their funds for wahala you go see say all these free thing fit put your funds for wahala. no matter d price wey dem dey talk tay wine you no fall for any shit. many guys wey I know don loss Dem money and e no get how u wan take get am back.
I con as my guy where e for dey see all these kind links to such rubbish sites, na e tell me say Dem full YouTube. you see the social medias today don turn something else. some time when even me dey scroll through you tube. I dey see many of such videos wey go write 10-20 website that can give you free money. all these sites are nothing but scams or fake website wey just dey there to catch people wey no smart. if Dem don do one or two thing finish you go dey see d money for there Dem go con tell you say make u deposit so so and so amount of money before you go withdraw. d worst part be say Dem fit use these links take hack your wallet. we should all be smart and vigilant. there's nothing like free money on the internet.