|
November 04, 2023, 11:44:52 AM |
|
My country people I dy hail ona inside dis hot afternoon, Wetin I wan talk about na how we fit stop stop godfatherism for we country naija because e dy really worrysome say most of this politicians go dy do anyhow for we country and believe say nothing go happen because say na him boy dy in power, an the sad part be say dat him boy wey be governor or presido no go do anything because na him godfather be dat.
Make we look at wetin shele between governor fubara of River state and him godfather wike, wike just wan to dy for Abuja dy control wetin happen for the state as if him still dy in power, even the fubara self don tire for the whole settings, the only day him go against him godfather because of the interest of the people, wike assemble all him catel men dem for the state with the intention of forcing fubara out of office.
I no just know where dis country dy go now because it's getting out of hand.
|