The only thing me still dey wonder na why I no put better money for Bitcoin the time I hear about am because that time, the price dey very low.
Even me too, imagine say I put better money when Bitcoin price been they very small how much person for done make, but although waiting worry me that time be say I never really sabi crypto and besides people been they reason online investment as investment way them fit scam people and that time 20k na big money to risk ooh because I been they fear say my money fit go.
But see how the price done reach now and everybody way been see am when in they cheap they wish say them for buy so perhaps that's why without risk e go they very hard for person to make am for this life.
Na true sha, assuming say people know the value of Bitcoin before or know say Bitcoin na better investment people for rush am self and people for even borrow just to invest and by now almost everybody for done make am but nothing spoil sha, time still dey to invest but before we go involved ourselves for crypto wey go first know the risks involved, no be only the benefits because no be everytime Bitcoin dey rise, at times e dey fall like mad n dat time, if person no dey careful person go get a big loss except say na long term investment person do, so mk we consider the things involve because as Bitcoin dey sweet na so e dey bitter too.