Omo you no fit carry bitcoin compare those other coins oh, in terms, durability, trust in yielding profits, and him get publicity and global acceptance pass any coin. Bitcoin dey lead, others dey follow for back.
As I dey now self, I no sure say I don see plenty naija people way get altcoins for their wallet self, if them dey them no too plenty reach bitcoin holders.
No you no fit compare Bitcoin users to altcoins oh, Nigerians self dey hardly hold Bitcoin na we for this forum na him know the true value of Bitcoin like dat, join this altcoins channels them and you go see say Nigerians plenty wey still dey chase after altcoins gains. Search on twitter too and you go see them plenty for this projects comment section which go mean say dem dey buy dem even though no be everybody wey we dey see there dey Invest. Nigerians also dey Bitcoin but I go say we dey altcoins pass. Projects like Nigerian ehh that's why you dey see say dem get Nigeria telegram channel like other countries too wey dey big in cryptocurrency. More nigerians dey after the profits and you no go say we dey after the technology that's why you go see us plenty for this altcoins especially shitcoins dem. Me I know people wey dey the industry and dem never buy Bitcoin before but you dey see shitcoins and altcoins in general, dem fit spend better money there they Invest and they lose (but gains dey come sometimes sha)
As for me even forum sef I never see am from altcoins even Ethereum wey I dey tok for here sef I never see im forum wey e dey like this one. And many persons no like altcoins because dey too dey disappoint person.
The sentiment on the forum is Bitcoin is the king (which isn't wrong) but if you check for people wallet dem get altcoins together with Bitcoin. Some dey Invest, other they trade dem but na only very few people wey never invest in altcoins for their life. Me I dun buy altcoins well before, I make and lose but the truth be say if I been put all that money inside Bitcoin, the gain for come out well pass altcoins. The reason people dey go for altcoins na say e dey give profits fast but just know say as the profits dey come na so e go go too but sha if you dey smart and fit sell before e crash na better profits you go make but since we can't be lucky always e just better to stay with Bitcoin and you won't regret it like most altcoins investors do.