Me I don talk am before if anyone dey invest make im dey do at least a minor work or job to support his investment so dat e go last for am.
Na better talk you talk for here so, this has also been my advise, abeg if you wan do investment we no dey talk say you no fit invest when you no get work oo, no reason am the wrong way, e dey very vital for person wey wan enter this investment journey to get work wey go dey back am up so that e fit dey do DCA, e no matter the amount wey you dey put inside, your own na to just do according to your strength after all na your money. Reason we dey talk so na because most people wey never get work wey come enter this bitcoin holding, before you go know dem don go sell their coin use the money do something else. Dem say small drop of water dey make a mighty ocean, if you wan know how true this statement be just try DCA and you'll testify later.
Normally if you dey follow up the Bitcoin matter very well you go understand say now na the best time to buy Bitcoin, no be to dey wait till halving do n reach because by that time price go don change normally and e go come be say people wey buy now naim buy cheep sef
Yes oo, now is the beat time to buy, we never know weda this na the lowest price wey we go experience before the halving so make we no carry am play or procrastinate any futher.
Invest now and site back to reap the profit later.