|
December 17, 2023, 05:41:14 AM |
|
Naim be your country for you, any small thing wey dem manage get opportunity DRM go use am to the fullest, then latter we go come for y blame government for their failures and corruption when the corruption start from us dey go, make I even gist una wattin bring this banning of keke driving for night make una dee how human being wicked, based on say aboki dem many wey dey do this keke business for we state, one day one aboki come carry passenger matured youth wey don serve NYSC finish, do him and the guy come dey get small misunderstandings with N50 aboki day the guy go give am N50 while the guy say na 100 e dey pay ever since, naim the aboki carry daga go stab the boy, and the come die. So just imagine because of N50 naira person kill em fellow human being, very nonsense story.
|