The op no try for the post way in go make for English board on how this forum don help create employment for Naija youths. Na the person who carried him to this forum I blame because the person no guide am say this forum na where to gain knowledge about Bitcoin, to adopt the strategy in accumulating Bitcoin, and not where to earn money. The guy made it clear saying na Yahoo hustle our Naija youths be dey do before they discovered this forum and na this type of people they make why Nigerians no go freely register for here without paying a token for the account to be ready to use.
Bros no be this OP wey open that thread oh, nah another wrong man wey this current OP talk about.
And I no sure say person wey introduce Bitcointalk to that guy wey fall our hand , I no sure say the person just tell am about this Forum and leave am like that, him fit guide this guy but we all go agree say even as the guy tell am about this Forum, this guy go still do wetin dey em mind.
This thing nah personal decision becos wetin him type the person wey tell am about Bitcointalk no go dy dia to address him movement or choice of words, so I say this guy don carry our face clean ground without respect .