Baba I greet oo, I no say you wan try to locate others so that una fit hangout for the same territory but make I still clear you say to provide this kind of more detailed location for were you dey stay and you know say we not supposed to even release these kind of information especially for forum like wey majority of our talk na money matter we dey talk. To be honest e nor dey safe as e be say many outsiders don dey fit understand our local pidgin. My brother safety first oo, make Dem for no use us chop Christmas oo.
The way una Dey Dey take handle this privacy matter no follow at all and it seems a lot of people Dey get very wrong conception of what privacy means in the forum but nevertheless, I no been dey ask so we fit hangout but I been Dey ask to fit get familiar and who Dey hangout for this hard times wey even pure water don get very serious level😂
~snip~
normally from the bari when de your name e don show say you me better OG boy and I doubt say na only you mount for this ama.
Normally from the name I be eleme boy and the difference na the “o” wey Dey before the bari but nevertheless we all be the ogonis but I been wan clear say eleme na council on its own but with regards to our hero KEN we all are the OGONIS