Bitcoin Forum
May 01, 2024, 11:18:46 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: MLM na dangerous marketing strategy  (Read 147 times)
Mia Chloe (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 336
Merit: 493


Math + Code = Blockchain 😁


View Profile
December 15, 2023, 08:43:02 AM
Merited by 1miau (10), Hatchy (2)
 #1

Topic translated in Pidgin : MLM na dangerous marketing strategy
Original Topic: MLM – a dangerous marketing strategy
Author: 1miau


ABEG DE CAREFUL: abeg oo no go invest ur moni 4 MLM System u no go get d moni way u invest put back. D gist way de after dis one go explain y:



As u go take no say na MLM System

As u de fine beta Beta chance 4 place  to take invest moni put, u fit com jam all dis bizness way Dem de call MLM. D full meaning of MLM na Multi-Level-Marketing and Dem de use am well well take de catch new customer. Multi-Level mean say pipo way don de d business  de put new customer join. And dis pipo way don already de d business de receive commission anytime way dis new customers way Dem refer deposit moni.

Many of dem de get many many level way Dem de pay commission 4 pipo way Dem refer.
Wen pesin way u refer com refer anoda pesin u go com sti get small bonus afta d pesin way e refer sti deposit.
If u Fe look d matter e resemble  watin gain de say once u refer pesin u go get bonus.but if u reason am wel wel u go notice say no b beta mata and e go good if u avoid to de invest 4 Multi-Level-Market system Dem.




d way MLM of BitConnect Ponzi-Scam take arrange. To de refer new pipo join go de give some kind bonus way go depend on watin who Dem refer deposit.



Anoda promise way all dis project way no clear de give na say Dem go de multiply crypto way u ge wit small time. Some of dis  MLM project sef go even get ogbonge bonus if u invest more moni put say u go com de get beta gain fast fast:




Dis MLM matter cast well well 4 crypto matter  bcos crypto de bring beta gain  “if moon com” and pipo way no get beta experience  put nai him Dem de target  pass. Dat time way Dem de hype am dat kind 2017 ending many Ponzi pipo use d  “when moon” take raise moni even if say d business  de lend or mine.many Times na lie lie promise to take put pipo inside.
To take add join, Bitcoin and other  cryptocurrency de complex 4 new pipo way de use am, and e somehow de  easy 4 scammers to take fool dis pipo com sell fake business model say na real one.


U fit no MLM with structure way resemble pyramid, if u get different level of referral bonus and mostly if big gain de com every day or every month. MLM system way pipo no well well na BitConnect and BitClub.




Afta BitConnect tay crash, their coin con almost  de useless.



To take  add am  up, here na d general disadvantage of MLM system and y u suppose avoid any of Dem  investment:


1. MLM match wit scam

MLM no really  mean say d project na scam but many many times na scam Dem b.dis one na bcos say MLM de easy 4 operator to take get new customers join wit d ones way don already de wen Dem de advertise d service.E de beneficial 4 pesin way get d platform since na customer de advertise am and na new members de fund am.so pesin way get d MLM system de face zero risk and e no de pay 4 marketing.if d owner don get enough money from inside Dem go com close d platform and customer no go fit withdraw Dem moni again. Na dis one dem de call "Exit- Scam".


 Ponzi go always reach point way new customers way de make deposits no go reach bcos say Dem de pay d pipo way don already de wit moni way new customers deposit. Na only redistribution of moni bcos e no de generate profit come out.

But even if say  any MLM de generate real profit, some things de to put4 mind.


2. MLM de cause significant costs

If profit de way Dem de  generate, business way base on MLM go need to spend beta part  of their profit on top commission way dem suppose pay 4 MLM-expenses. Depending on d numba of level way de and d amount of each commissions way Dem de pay, and this matter  fit chop beta tin commot from their profit.
To add join de profit way Dem need to spend no longer de available 4 normal investments, which get bad effect 4 money way customer de earn.4 here d customers de pay 4 d marketing.

Bcos of dis one,business model way legit no go use MLM most times bcos e no de profitable 4 beta development of the company.



3. Only d pipo way quick invest and invite many pipo go benefit from the MLM

Bcos  of d affiliate structure, d pipo way quick  invest (mostly d pipo way get am) and d ones way refer pipo pass go benefit d most.dis referral commission moni de com directly from d customers way de under Dem 4 deir downline.
And normally, d owners de always make profit 4 MLM systems, otherwise Dem no go run am.

Anoda important point na; d pipo way de advertise their project no pure wen Dem de present d business model. Dem go advertise d product in a way way Dem go likely get more referrals (and  bigger bonus) bcos  of d affiliate structure. D result na dangerous dynamic way go give bad eye to d product .na dis one Dem de mostly call “shilled project”.



4.  MLMs no de open an clear

Beta legit projects de always de interested to make their business model de transparent make pipo 4 get reason take invest,tins like how Dem de generate profit, which team de  hold d project and how Dem de divide d revenue (team / expenses / profits for investors). Sha but most cases dis  projects no de get multi-level marketing system. Wink

Many times  transparent structure of the company in MLM projects no de de, 4 where Dem nor no d operators or na small Dem no Dem and na customers de market am. Na beta style 4 d owners to take hide demsef con sti get big marketing.

Especially pipo way no de experienced na him Dem de target wit dis marketing strategy wit big promise way Dem de give Dem like " new Bitcoin", "Lambo or Moon" or other returns way no de realistic


If d business model na good one, MLM way get clear commissions fit be viable and legitimate marketing , but tins way don sup b4 don show d opposite.

Finally, multi-level marketing systems de mostly discouraged bcos high risk of scam de and even if no b scam de structure no de favor customers but e de favor d pipo way start am.



▄▄███████▄▄
▄██████████████▄
▄██████████████████▄
▄████▀▀▀▀███▀▀▀▀█████▄
▄█████████████▄█▀████▄
███████████▄███████████
██████████▄█▀███████████
██████████▀████████████
▀█████▄█▀█████████████▀
▀████▄▄▄▄███▄▄▄▄████▀
▀██████████████████▀
▀███████████████▀
▀▀███████▀▀
MΞTAWIN  THE FIRST WEB3 CASINO██████
██
██
██
██
██
██
██

██

██

██

██

██████
.
 PLAY NOW 
██████
██
██
██
██
██
██
██

██

██

██

██

██████
The forum strives to allow free discussion of any ideas. All policies are built around this principle. This doesn't mean you can post garbage, though: posts should actually contain ideas, and these ideas should be argued reasonably.
Advertised sites are not endorsed by the Bitcoin Forum. They may be unsafe, untrustworthy, or illegal in your jurisdiction.
1714605526
Hero Member
*
Offline Offline

Posts: 1714605526

View Profile Personal Message (Offline)

Ignore
1714605526
Reply with quote  #2

1714605526
Report to moderator
Mia Chloe (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 336
Merit: 493


Math + Code = Blockchain 😁


View Profile
December 15, 2023, 09:57:19 AM
Last edit: December 16, 2023, 10:31:03 AM by Mia Chloe
 #2

I greet oo my pipo
To carry dis interesting matter come my local board too sweet me bcos I don come across many pipo way don go broke bcos of dis MLM Ponzi scheme Dem. Dis MLM matter don too cast 4 9ja but d matter b say many pipo sti de fall put bcos of the situation o d country or bcos of greediness.I believe say many of us don sti likely com across dis Ponzi MLM Dem bcos Dem full internet.dis post na better eye opener to pipo way de quick invest moni put for referral website.  Abeg make una shine eye oo
My contri pipo una wel done oo

▄▄███████▄▄
▄██████████████▄
▄██████████████████▄
▄████▀▀▀▀███▀▀▀▀█████▄
▄█████████████▄█▀████▄
███████████▄███████████
██████████▄█▀███████████
██████████▀████████████
▀█████▄█▀█████████████▀
▀████▄▄▄▄███▄▄▄▄████▀
▀██████████████████▀
▀███████████████▀
▀▀███████▀▀
MΞTAWIN  THE FIRST WEB3 CASINO██████
██
██
██
██
██
██
██

██

██

██

██

██████
.
 PLAY NOW 
██████
██
██
██
██
██
██
██

██

██

██

██

██████
DubemIfedigbo001
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 294
Merit: 229


Let love lead


View Profile WWW
December 15, 2023, 12:54:36 PM
 #3

Most MLM business models now are obvious scams, the truth here is that people know that they are likely  to be trapped, but due to the high frustration and hardship in the country, the same people brainwash themselves on the possibility of cashing out before it crashes. these sites pays only those who gets in early and the unfortunate late ones are used to enrich the organizers of such schemes. For me, any business that involves gathering people and high ROI is not to be trusted at all cos looking critically at the business models, you can see that what they project to be doing with the users funds cannot yield such revenue that they pay to the user, talk less of the money they make for themselves.
I had a friend who did the recently crashed NHire. When they were enjoying the proceeds from their early #10k investments on a daily basis, I tried to make him understand that that forum would not last long seeing that they only run ads for goods to be bought and they pay as high as #1800 per post, I was thinking of how much they actually charge the business owners that can cover for the hundreds of thousands of people they pay #5100 daily. we analyzed it together, but he seemed not to be interested in my analysis, I encouraged him to stop spending excessively and save for the time his commission will stop coming, he heeded my advise a little and it helped him three weeks later when they stopped paying. He himself couldn't believe it could crash, but reality surprised him.  All these MLM marketing models with high ROI are not to be trusted at all, they're all obvious scams.

Tuclikk
Jr. Member
*
Offline Offline

Activity: 76
Merit: 3


View Profile
December 15, 2023, 02:22:28 PM
 #4

Especially pipo way no de experienced na him Dem de target wit dis marketing strategy wit big promise way Dem de give Dem like " new Bitcoin", "Lambo or Moon" or other returns way no de realistic


If d business model na good one, MLM way get clear commissions fit be viable and legitimate marketing , but tins way don sup b4 don show d opposite.

Op thanks for the message ah get person wey been dea capp people abau the update say e dea pay but na tin you refer person and he/she make deposit na him you go dea get commission. This kind thing wey be say na tin you refer you go omoo e no dey legit at all. we Gaz dea very careful with this things that are coming because most people wey be say dey wan make ahm fast abeg make we de very extra careful if possible.
Obim34
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 238
Merit: 202



View Profile
December 15, 2023, 06:42:39 PM
 #5

If na about this MLM matter eh, nothing wey person go preach for me wey I go accept say no be scam activity be this, all this follow for ponzi no matter how dey want use decorate am na sure something say dey must crash one day.
I even see this one the way dey come out publicly dey show their face dey promote am, e still no go make me pertake for am but e sure me say many people dey wey go fall victim and I go just dey one side dey watch.
Normally dey go pay their first users to attract more people but e dey certain dey no go last too long, so that money any of us go use go invest inside there, I go advise make we carry am take add Bitcoin for our portfolio.

Makus
Full Member
***
Online Online

Activity: 322
Merit: 214

Bitcoin!!


View Profile WWW
December 16, 2023, 08:02:14 AM
 #6

E don Tay wey all this kind things dey exit for this life, even for Nigeria def, Dem many wey I don jam, e get one tym sef I nearly fall for one of Dem wey Dem dey call NEW LIFE l. This people so mouth sweet me untill I been wan join, if to say any of una don attend their seminar you for understand wattin I mean,  the people wey dey involved are very good marketers wey sabi persuade person and Dem sabi talk fast. Anyway ones I hear say the entire money process dey gbakam for referral, I just no say no be my thing be that, that time wey I been dey find work naim Dem be wan use my head because na from vacancy bill naim I take get their number and when I call Dem come direct me go their side. I no go advise anybody to put body for that kind thing oo, because inside the business so na you go dey find people wey you go bring come join, under sun and rain.
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!