Yeah we see lots of persons who actually fall into the category of being shy on their business advertisment, but are very good with the skill. Most times, they are even better than those who show off their skill on social media and public discussions. People who tend to be shy or not into business advertisment might be due to illiteracy, because most of those people who actually takes this hand work serious are those who chose it from the start and have made it their life career unlike some that went to school and still feel those skill/ handwork are just temporary hustle.
I no go lie you the person wey dey work out generator na so e be, e nor dey talk too much, and e not go school but, if that guy touch your gen hand, you go know say person touch your gen, be it servicing or any thing, provided say e touch the engine part, your gen must change sound and work well. So people like this dey very real but you nor go know until you try Dem, then your mind go dey.
Wetin u just talk now na true be that, no body everybody dey sabi show off, and those kind people, if u see them self, u go talk say this one nah mumu, person go dey look down on them like say dey fit know anything, but if u see those kind people in action ehn, or u came mistakenly come across them for wer dem dey work, u go shock, even some people wey go school dey like that, some of dem no dey too show themselves too, if dey no show person their certificate, na so person go dey underrate dem, na those people wey nothing dey for their brain self, na e dem dey over show demselves, them dey over do, shakara no go gree them but nothing dem sabi, to do work well self na problem and truth be told , for this our country na those kind people na e no dey waste time make am for life quick but u see those people who work diligently, if no be grace of God, people no go recognize them but I like my country people, them no dey reason government work, once u get wetin dey put food for ur table, they are good to work, beside government work na monthly and e no really dey easy to save. So I prefer being rich on a low-key.